Blog sidebar

Background

National

Ilu-Abo Residents Block Highway Over Gunmen Killings, Abductions

By: Esther Ayoola Say Some Pipo from Ilu-Abo community for Akure North Local Gornment Area for Ondo State scata ground yesterday, dey protest say, di way pipo take dey kpai, kpai and jaguda boys kidnaping dia pipo don tire dem. According to report, Dem block Akure-Owo-Benin highway to make gornment hear wetin dey happen and say security nor dey shake bodi for di mata. One protester, wey name na Lawrence, […]

todayJanuary 27, 2026 22

National

President Tinubu Land Ankara For State Visit

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don land for Ankara, capital of Turkiye, for state visit. Im plane touch ground around 9:03pm, local time, and Turkish gornment pipo wey Minister of Education, Yusuf Tekin lead, ni welcome am for Airport. Nigerian embassy pipo for Turkiye, including Chargé d’Affaires Ambassador Zayyad Abdulsalam, join receive President Tinubu. Untop corner, corner yarnings with tori pipo, Yusuf  say Baba seyi  entering […]

todayJanuary 27, 2026 15

National

APC Konfamate Dat Shettima Remain Tinubu Running Mate For 2027

By: Esther Ayoola Di All-Progressives Congress don clear mata say APC nor get plan to change Vice Presido Kashim Shettima as Bola Ahmed Tinubu running mate for 2027. Na APC publicity secretary, Felix Morka, tuk dis one for TV sit don tuk on Monday. According to Morka, law nor permit dem to start serious election mata for now but di yarnings of changing oga vice presido, na okpata yarnings.

todayJanuary 27, 2026 13

National

Abba Yusuf Explain Why Im Rejoin APC For Kano

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf, don officially return back to All Progressives Congress (APC) on Monday for Coronation Hall inside Kano state gornment House. Big party leaders like former APC National Chairman and former-Kano State govo, Abdullahi Ganduje, Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, and Minister Yusuf Ata receive am alongside otherleaders. Governor Yusuf tuk say, im decision na because, e wan work more closely with Federal Gornment […]

todayJanuary 27, 2026 14

National

Court To Decide Minister Wike Fate Today

By: Esther Ayoola National Industrial Court for Abuja don fix today (Tuesday) to give ruling for one case wey FCT Minister, Nyesom Wike, and FCT Administration carry go court against leaders of Joint Union Action Committee (JUAC). Justice E.D. Subilim hear argument from both sides before e adjourn di mata for last sitting. Wike and FCTA dey ask court, make e stop JUAC Chairman Rifkatu Iortyer and Secretary Abdullahi Umar […]

todayJanuary 27, 2026 20

National

CDS Insist Army Must Dey People-Centred, Protect Civilians

By: Esther Ayoola Di Chief of Defence Staff, Gen. Olufemi Oluyede, don repeat tuk say Nigerian Armed Forces go dey people-centred, ethical, and accountable. Im yan dis one for Human Security and Gender Advisers Course wey hold for Abuja through Maj.-Gen Ibrahim Lassa. Gen. Oluyede tuk say, security wahala dey complex, with terrorism, communal fight, transnational crime and humanitarian issues wey dey affect ordinary people everyday. According to Oluyede, di […]

todayJanuary 27, 2026 12

obodo oyinbo

U.S. Top Immigration Oga, Greg Bovino To Leave Minneapolis

By: Esther Ayoola Top U.S. immigration oga, Greg Bovino and some agents go leave Minneapolis afta federal officer shoot one U.S. citizen, Alex Pretti,  and say e cause serious gbege  for  di town. President Trump don send im “border oga” Tom Homan go manage immigration work for di city as people dey watch wetin go happen next. According to report, dis kain move fit mean say, White House wan reduce […]

todayJanuary 27, 2026 12

obodo oyinbo

Australia Cancel Israeli Influencer Visa say E Tuk Bad About Islam

By: Esther Ayoola Australia don cancel visa for one Israeli influencer, Sammy Yahood, wey dey spread hate against Islam. Untop post for X, Home Affairs Minister, Tony Burke don make am clear say, make nobodi come Australia con spread hatred. Wetin di influencer writer, say, Yahood write say Islam no dey tolerate non-believers, women, pikins, and gay people, ni be di probelm. Australia Gornment like dis don dey tighten hate […]

todayJanuary 27, 2026 13

Sports

Green Arrows Ready Bodi For Dia African Men Handball Final Group Game Against Egypt

By: Esther Ayoola Say, Na today Nigeria Green Arrows go jam defending champions Egypt for big Group I match for African Men Handball Championship. Winner go secure semi-final spot plus direct ticket go 2027 IHF Men’s World Championship. Egypt dey lead di group with two wins, 83 goals scored and 56 goals wey dem don concede, while Nigeria dey second with one win and one loss. Egypt na one of […]

todayJanuary 27, 2026 8

Sports

Efe Ajagba Jim Bodi for Charles Martin Dis Valentine

By: Esther Ayoola Nigerian heavyweight, Efe Ajagba don dey do jim jim di bodi to face former IBF champion Charles Martin for Zuffa Boxing third Paramount+ show on February 14 for UFC Apex, Las Vegas. Di fight tuk don dey table since November 2023 when Top Rank plan am first, but e never hapun since den. Ajagba wey be 2016 Olympian, get record of 20-1-1 with 14 KOs, comot from […]

todayJanuary 27, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds