Blog sidebar

Background

Sports

Osimhen And Galatasaray To Show Muscle For UCL Survival

By: Rilwan Agbomeji Super eagles Striker, Victor Osimhen and im club Galatasaray dey at risk to drop out from UEFA Champions League today, afta collobing just 10 points and sitting 17th for di champions league table. Galatasaray dey fear say dem fit comot from Europe top competition if dem nor avoid heavy loss. Dem go play final group match for Manchester City wey sef need win to enter top eight.

todayJanuary 28, 2026 12

Sports

Egypt Crush Nigeria 48–22 For Africa Handball Championship

By: Rilwan Agbomeji Egypt don wunjor Naija Golden Arrows, showing dia strong doings for handball, say dem beat Nigeria 48–22 for BK Arena, Kigali on Tuesday. Di win mean say, Naija nor go play semi-final and nor qualify for di 2027 handball World Championship. Egypt control di game from start, dem lead 24–10 by half-time before dem continue crushing Nigeria for second half. Egypt shooting sharp wella,  na so di […]

todayJanuary 28, 2026 12

OBODO NAIJA

Shettima Welcome Govo Mutfwang Enter APC

By: Rilwan Agbomeji Vice Presido Kashima Shettima don officailly welcome Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, enter di All Progressives Congress, praise am say na leader wey sabi welfare and peace. You sabi say, Konfam bin report dat Mutfwang dump di Pipos Democratic Parti three weeks ago because of di katakata for di party. For di welcoming ceremony for Jos on Tuesday, Shettima tuk, tuk heaven and earth,  say Mutfwang get […]

todayJanuary 28, 2026 14

OBODO NAIJA

Türkiye Promise To Tanda With President Tinubu To Rascal Terrorism

By: Rilwan Agbomeji Turkish Presido Recep Erdogan don go promise wi oga presido, Bola Ahmed Tinubu, say Türkiye dey ready to support Nigeria fight against all di jaguda boys bad, bad doings for Naija. Say im ready to joinbodi with Naija military to do training with wi army dem. Erdogan yarn dis one for joint press conference with President Bola Tinubu during Tinubu official visit to Ankara. Na baba seyi […]

todayJanuary 28, 2026 17

Lagos

Lagos Gorment Clear Mata Of Tax Collection

By: Rilwan Agbomeji Oga Chairmo of Lagos State Internal Revenue Service (LIRS), Dr. Ayodele Subair, don clear mata say, dem nor dey debit any company account directly if dem never pay tax. E yarn dis one for tv sit don tuk, say LIRS just wan collect unpaid tax from companies to fit provide beta things for Lagos. Subair explain say, nobodi go impose tax on person or companies wey dem […]

todayJanuary 28, 2026 13

Lagos

Police Arrest Jaguda Wey Threaten To Bomb Lagos School

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Police command don arrest one man, Kosiso Chukwem-Nenyem, say n aim send di alleged bomb threat messages via WhatsApp to two schools for Lagos. Commissioner of Police, Olorundare Moshood Jimoh, talk dis one when e dey brief tori pipo for Command Headquarters, Ikeja, on recent security operations. Jimoh press tuks on di arrest wey dem  don make for past  di weeks.

todayJanuary 28, 2026 15

National

Falana Question Military Why Dem Lie To Nigerians

By: Esther Ayoola Human rights lawyer Femi Falana don knock Nigerian military for head say make dem apologise to Nigerians for lying to dem. U sabi say, di army say dem wan carry some officers go military court over alleged plan to overthrow government, even though dem bin deny am before, no coup any earlier. Last year October, dem arrest 16 officers indiscipline mata and not knowing say, dis military […]

todayJanuary 27, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment, Private Sector Collabo To Boost AI Use For Nigeria

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don decide to join hand with private sector to hellep fast-track Artificial intelligence, AI, use for di obodo Nigeria. Dem say di way technologia dey waka wawawa, say, if gorment nor dey careful, say person go lose control. Commissioner for Energy and Mineral Resources, Biodun Ogunleye, yan dis one for corner coner tuks for di 2026 tecnologia conference wey dem title “AI in Action […]

todayJanuary 27, 2026 14

Lagos

Lagos Gorment Set To Hammer Drainage Spoilers For Lekki Area

By: Esther Ayoola Lagos State goment don cut chain, say dem go change am for any kain person wey go block drainage and break environmental law for Lekki, just to hellep protect di area from flooding. Environment Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one as e dey inspect drainage work and flood areas for Ogombo, Ikate, Mobil Road and other nearby communities. Wahab say dem get correct informate, say, some pipo […]

todayJanuary 27, 2026 24

National

Soun, Alaafin Comot Bodi For Oyo State 50 Years Anniversary

By: Esther Ayoola Two big traditional rulers for Oyo State, Soun of Ogbomoso, Oba Olaoye Ghandi and Alaafin of Oyo Oba Akeem Owoade, ni comot bodi for Governor Seyi Makinde celebration of Oyo state at 50 on Monday. Plenty important pipo like family members of former govos, traditional and religious leaders, gornment oga dem and political big men gather for International Conference Centre, Ibadan, to mark di celebration. Oyo State […]

todayJanuary 27, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds