Blog sidebar

Background

National

President Tinubu Rush State Police Law Inside Naija Constitution

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu like dis unto di worwor security doings for obodo Naija, don package state police creation put inside naija Constitution send go give Senate. Di bill wan amend di 1999 Constitution so e go give legal backing for state police system across all di federation. Dis move come afta plenty calls from Tinubu make dem reform di Constitution so states fit get more […]

todayJune 23, 2026 11

National

How Ondo Church Elder Go Kpai For Inside Hotel Room

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don begin touch light di death of church Elder, Omotayo Fajana, whether senior man go migrimor, no body know, say dem find im body for hotel inside Akungba-Akoko. Di 71-year-old pastor bin dey town for one church programme where dem suppose install am as Baba Aladura for Church, Okerigbo. Police tuk, tuk person, DSP Abayomi Jimoh, konfam di incident and tuk say dem […]

todayJune 23, 2026 17

National

Former Delta State Govo, Okowa Beg EFCC For Im International Passport

By: Esther Ayoola Former Delta State govo, Ifeanyi Okowa, don reportedly waka go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) office for Lagos to request for im international passport wey dem seize. According to aproko pipo inside di agency tuk say di visit na part of discussion to allow am collect di travel document so e fit travel go abroad for medical treatment. Di former govo bin get mata with di […]

todayJune 23, 2026 9

Sports

Adesanya Reject Retirement Tuk

By: Yusuf Abuh   Former UFC middleweight champion, Israel Adesanya, drop micro soft word say he no get plan to retire from MMA despite im current bad run. He tuk dis one for interview on Monday. Dis one sef na afta four straight loss, last one na when Joe Pyfer knock am out for UFC Fight Night 271 for Seattle for March.   Di losing streak also include defeat to […]

todayJune 23, 2026 11

Sports

Ogundinran Win 100m Gold for Lagos Trials

By: Yusuf Abuh   Unto di commonwealth trail for Lagos, Blessing Ogundinran wey base US naim collobi n women 100m title for 2026 Commonwealth Games National Trials for Lagos, as she run 11.12 seconds to become Nigeria new national champion. She beat young athlete Miracle Ezechukwu wey follow close behind with personal best of 11.15 seconds, while Olajide Olayinka come third with 11.28 seconds. Di race happen for Lagos and […]

todayJune 23, 2026 15

Sports

Man United Secure Land for New 100,000 Stadium Project

By: Yusuf Abuh Manchester United don announce say dem don secure most of di land wey dem need to build dia new 100,000-capacity stadium. Di club talk say dem buy  25-acre site near dia current Old Trafford home ground. Dis land deal na big step as e go help dem move closer to plan of building one of di biggest stadium for Britain.

todayJune 23, 2026 10

obodo oyinbo

Badenoch Drag Starmer, Call Am “Terrible PM”

By: Yusuf Abuh   Kemi Badenoch don describe Keir Starmer as “terrible Prime Minister” afta e announce im resignation as Labour leader and UK Prime Minister. Starmer talk say e go step down from Labour leadership afta less dan two years, but e go still remain Prime Minister until dem choose new leader. Badenoch react for X say di Labour gornment fail wetin no good, for policies, including tax increase, […]

todayJune 23, 2026 8

National

Tinubu Appoint New NUC Board Chairmo

By: Yusuf Abuh   Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint Professor Oluwatoyin Ogundipe as di new Chairmo of di governing board of National Universities Commission, NUC. Ogundipe dey take over from emeritus professor Olufemi Aina, wey resign from di position less dan one year afta im appointment. Baba Seyi bin appoint Aina for July 2025 and dem inaugurate di board members for November 2025. Ogundipe, wey serve as […]

todayJune 23, 2026 9

Lagos

DIG Fayoade Call For Body Camera For Police To Boost Accountability

By: Yusuf Abuh Di Deputy Inspector-General of Police in charge of di Southwest zone, Adegoke Fayoade share beta security doings say make police officers begin wear cameras for body bring beta professionalism for Nigeria policing. E make dis appeal during im visit to Lagos State Security Trust Fund office as part of im tour across Southwest states. Fayoade nor hide mouth tuk say Lagos dey very important for national stability […]

todayJune 23, 2026 7

Sports

France And Argentina Cruise Enter Next Round For 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh   Unto world cup update, France national football team don show again say dem no come World Cup to con joke as dem beat Iraq 3–0,  wey make dem move to di  next round, Mbappe score two goals and Dembele naim collobi di last one. Meawhile, Argentina sef do dia own for one conner, dem settle down beat Austria 2–0,  with Messi scoring two goals. For another […]

todayJune 23, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds