Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

FG Promise to Package NECO Exam Cheap for Naija Student

By : Jolayemi Olajide Vice Presido Kashim Shettima like dis say Federal Gornment go continue to make national exams affordable for Nigerian students while dem dey improve exam integrity and innovation. WI Vice Presido yarn dis on Thursday for Abuja during the 25th anniversary celebration of National Examinations Council, popularly known as NECO. Shettima, wey im Senior Special Assistant on Legal and Compliance, Bashir Maidugu represent for di event, tuk […]

todayMay 7, 2026 13

OBODO NAIJA

US Court Indict Nigerian man Over Alleged Casino Fraud

By : Jolayemi Olajide United States Department of Justice on Wednesday announce say federal grand jury don indict one Nigerian man, Kenneth Godwin, over alleged plan to steal money from Prairie Wind Casino and Hotel for South Dakota. According to US authorities, Godwin and some other people allegedly carry out wire fraud and illegally access protected computer systems between May 2023 and March 2026 to move money from the casino […]

todayMay 7, 2026 20

OBODO NAIJA

How NDLEA, US join force Arrest Alleged Nigerian Drug Baron for Switzerland

By : Jolayemi Olajide National Drug Law Enforcement Agency, alongside United States Drug Enforcement Administration and some European security agencies, don Gbab one suspected Nigerian billionaire drug baron, Amadi Simon, for Switzerland say im commit international drug crime NDLEA Tuk, tuk, Femi Babafemi, naim make dis announce di development on Thursday, saying na beta intelligence dem take run di arrest. According to di agency, operatives also arrest two alleged accomplices […]

todayMay 7, 2026 13 3

OBODO NAIJA

Jonathan Tell Youth Group Say E Go Consult Before Deciding On 2027 Presidential Race

By : Jolayemi Olajide Former Presido, Goodluck Jonathan address some youth groups for Abuja on Thursday, telling im dem to dey patient and dat Nigeria presidency no be “computer game”. Jonathan yarn dis one when some youths go visit am for office to pressure am make e return to active presidential politics, Jonathan reply an say im need to do wide consultation before taking any final decision because leadership require […]

todayMay 7, 2026 28 2

OBODO NAIJA

NNPP Spokesman Ladipo Johnson Resign for 2027 Political Realignment

By : Jolayemi Olajide   National Publicity Secretary of the New Nigeria People’s Party (NNPP), Ladipo Johnson, don resign from im party say na  political realignment  for 2027 general elections. Johnson submit im resignation letter to the NNPP Ward G1 (Shitta/Ogunlana Ward) chairman for Surulere Local Government Area of Lagos State, on Thursday. For di letter, e talk say di resignation dey take immediate effect, as e explain say na […]

todayMay 7, 2026 11

Health

Oyo State, Unfpa Train Health Workers To Care For Female Health

By : Jolayemi Olajide Oyo State Primary Health Care Board, together with United Nations Population Fund through Centre for Comprehensive Promotion of Reproductive Health, don arrange ogbonge training to strengthen advocacy against Female Genital Mutilation (FGM). Di training wey happen for oyo town, say health officers from all 33 local government areas gather, including Medical Officers of Health, Health Educators and Monitoring and Evaluation officers, to improve dia work on […]

todayMay 7, 2026 11

obodo oyinbo

Fresh Election Fit Shake Keir Starmer Government For UK

By : Jolayemi Olajide Millions of voters for United Kingdom don flood polling units as fresh election don turn big survival test for Prime Minister Keir Starmer. Almost 5,000 seats dey ground, and early polls dey show say Labour Party and Conservative Party fit chop serious political breakfast. Nigel Farage and im Reform UK party dey expected to shake table for England, while pressure don begin mount on Starmer as […]

todayMay 7, 2026 9

OBODO NAIJA

APC Remove Screening For Presido Bola Tinubu For Di Primaries

By : Jolayemi Olajide All Progressives Congress (APC) don cancel screening requirement for Bola Ahmed Tinubu ahead of di 2027 primaries. Dis decision come out from di party National Working Committee during dia 188th meeting wey happen on Wednesday, for di party national secretariat. For statement wey party tuk tuk pesin, Felix Morka release after di meeting, e talk say di waiver follow party rules, and Tinubu don officially get […]

todayMay 7, 2026 11

Lagos

GAC Ogas Giv Mukhail Abiru Green Light For Another Term

By: Jolayemi Olajide Leaders of Governance Advisory Council (GAC) for Lagos East Senatorial District don speak with one voice, endorse Mukhail Adetokunbo Abiru make e return to Nigerian Senate for another term ahead of 2027 election. Di endorsement happen on Tuesday for house of Busura Adedeji Alebiosu, and na strong sign say party leaders trust Abiru performance since e enter office. Di GAC leaders, wey be top decision makers for […]

todayMay 7, 2026 10

OBODO NAIJA

Keyamo explain ADC and Obi Relation say na toxic Relation

By : Jolayemi Olajide Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don fry mouth on why former Labour Party presidential candidate, Peter Obi, im move from African Democratic Congress (ADC) go New Democratic Congress. Keyamo tuk dis tuk for news statement on Thursday, dat di whole mata be like man wey love woman but no fit promise am marriage, so di woman later just waka commot. He still tuk […]

todayMay 7, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds