Blog sidebar

Background

Sports

Kayode Oke Score Goal After 18 Seconds

Kayode Oke, wey dey play for Bendel Insurance, score di quickest goal for dis season NPFL as e put ball for net just 18 seconds after match start against Sporting Lagos for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Even though Oke give im team early lead, Bendel Insurance no fit maintain di lead as Sporting Lagos fight back to win di match 2-1. Victor Samuel score di equaliser for Sporting Lagos […]

todayOctober 12, 2026 8

obodo oyinbo

One Kpai, 11 Wound For Saudi Airport Attack

One person don kpai, while 11 others don wound for attack on King Khalid International Airport for Saudi Arabia. Di attack happen hours after Houthi media report say airstrike hit airport for Sanaa, di capital of Yemen wey rebel dey control. Iran Foreign Ministry spokesperson, Esmaeil Baghaei, talk say Iran dey seriously worry about wetin dey happen for Arabian Peninsula. E say di way di wahala dey increase go only […]

todayOctober 12, 2026 12

OBODO NAIJA

LCCI Beg Gornment Make Petrol Price Drop by 15 to 20 Per Cent

Lagos Chamber of Commerce and Industry, LCCI, don ask federal gornment make dem reduce petrol price by 15 to 20 per cent within six months, so e go reduce di heavy cost of fuel and transport wey dey affect businesses and ordinary Nigerians. LCCI Director-General, Dr Chinyere Almona, welcome gornment plan to control petrol price, including di proposed ₦1,350 per litre limit for petrol cost before e reach filling stations, […]

todayOctober 12, 2026 14

OBODO NAIJA

Chief of Staff, Segun Ogunwuyi, Resign From Hin Job 

Segun Ogunwuyi, wey be Chief of Staff to Oyo State Govo, Seyi Makinde, don resign from di gornment on Monday, October 12, 2026. For im resignation letter, Ogunwuyi say im resignation start to dey effective from di same day wey im write di letter. Ogunwuyi, wey don serve before as member of Oyo State House of Assembly and House of Representatives, na one of several aides wey don resign from […]

todayOctober 12, 2026 9

OBODO NAIJA

INEC Talk Say Governorship List For Six States Na Fake

By: Mariam Ajayi INEC don tok say one announcement wey dey waka online about governorship candidates for six states na fake. Di commission tok am on Monday for dia social media, say dem no release any list for Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano states. INEC tell Nigerians make dem no mind di announcement because na fake news, e no come from dem. Dem beg Nigerians make dem no […]

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Bayelsa Gofnor Order Free Medical Check Up Every Three Months

By: Mariam Ajayi Bayelsa Goment don order free medical checks for residents across all eight Local Gorment Areas Governor Douye Diri give di order on Sunday for St John’s Anglican Church, Olobiri, Kaiama, to help people wey no fit afford medical tests. Di checks go cover high blood pressure, high blood sugar and cancer for government secondary hospitals, while di Health Commissioner go announce when di programme go start. Diri […]

todayOctober 12, 2026 8

OBODO NAIJA

FRSC Mourn Former Corps Marshal Dauda Biu

By: Mariam Ajayi Di Federal Road Safety Corps don mourn former Corps Marshal, Dauda Ali Biu, wey don die. Di current Corps Marshal, Shehu Mohammed, say Biu death na painful loss to im family, FRSC and Naija. Mohammed describe am as dedicated officer wey serve with discipline and commitment to public service. Biu join FRSC during di early years and later become di seventh substantive Corps Marshal, serving from July […]

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Federal Gornment Wan Launch Contractors Database

By: Mariam Ajayi Federal Gornment wan launch one new database for companies wey dey find gornment contract. Di Director General of Bureau of Public Procurement, Dr Adebowale Adedokun, announce dis one for Abuja during meeting with professional bodies on public procurement reforms. E explain say di database go help government check contractors’ skills, area of work, financial strength and past performance before dem fit get government contract. Di database go […]

todayOctober 12, 2026 8

Lagos

LAWMA Seal 25 Buildings For Okota Over Dirty Environment

By: Mariam Ajayi LAWMA don seal over 25 buildings for Okota because of dirty environment, as dem share 172 recycling bins give houses for Osborne Estate, Ikoyi. Di oga of LAWMA, Dr Muyiwa Gbadegesin, lead dem workers go clear plenty refuse wey people dump anyhow for Ago Palace Way, including road middle and around bridge. LAWMA carry compactor trucks, payloader, tipper trucks and street sweepers go clear di dirty place, […]

todayOctober 12, 2026 6

Sports

Boniface Vex Comot Field As Leverkusen Beat Mainz 4-3

By: Mariam Ajayi Nigerian striker, Victor Boniface, once again dey vex wetin nor gud, hin even comot field say coach nor play am for Bayer Leverkusen 4-3 win against Mainz for Bundesliga on Saturday. For di 84th minute, coach Carles Martínez bring in Equi Fernández and Jonas Hofmann, but na so Boniface sit don  bench, dey shine eyes, e nor believe say, hin coachie ignore am again, na so baba […]

todayOctober 12, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds