Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Court Order Final Forfeiture of 40 Properties Wey EFCC Link to Malami

By Esther Daniel Nor be small gbege, Federal High Court for Abuja don order final forfeiture of more than 40 properties wey EFCC link to former Attorney General and Justice Minister, Abubakar Malami. Justice Joyce Abdulmalik rule say Malami, im family members and some companies wey connect to the properties no fit prove say di assets no come from unlawful activities. Di judge also throway all the applications and motions […]

todayJuly 15, 2026 16

Lagos

Senate Presido do 50 million give away for oyo kidnap victims

By Esther Daniel Senate Presido, Godswill Akpabio don announce say e go give ₦50 million support to five families wey suffer from di recent kidnap matter for Oriire Local Government, Ogbomoso, Oyo State. Na ₦10 million each go reach di families of di three security officers wey kpai during the rescue operation and the two teachers wey kidnappers kill. As senators discuss di mata for plenary, dem still call on […]

todayJuly 15, 2026 10 2

Sports

How Tobi Amusan take Qualify for 2026 Diamond League Final

BY Esther Daniel Nigerian sprint hurdler, star gurl, Tobi Amusan, don qualify for the 2026 Wanda Diamond League Final after she perform well for the women's 100m hurdles race this season The former world champion gather 28 points from five Diamond League meets,take qualify for di September 4 and 5 tournament for Brussels, Belgium. For now, Amusan dey second for the Diamond League standings behind American athlete Masai Russell, wey […]

todayJuly 15, 2026 12

obodo oyinbo

Iran declare Say Hormuz Strait Go Remain Closed,

BY Esther Daniel Iran Revolutionary Guards don warn say Hormuz Strait go remain closed until the United States stop wetin dem call "acts of aggression" against Iran. The group also threaten say other oil and gas export routes for the region fit become target if the fighting continue. Since the clash between America and Iran start for late February, movement of oil and gas through Hormuz Strait don suffer serious […]

todayJuly 15, 2026 16

obodo oyinbo

UK-Based Nigerian Caregiver Die by Suicide

BY Esther Daniel One coroner court for United Kingdom don rule say 27-year-old Nigerian woman, Beatrice Solomon, don commit suicide say her head dey shake. Beatrice wey move from Nigeria go UK for Skilled Worker Visa for November 2023, police see her deadibodi for her house inside Norris Road, Stanfield. According to report from The Sentinel, during di touch lighting, her husband, Damian Butler, tell court say e comot house […]

todayJuly 15, 2026 9 1

OBODO NAIJA

Police Gbab 3 Railway Vandals, Recover N200m Stolen Rail Tracks for Oyo

BY Esther Daniel State Police do small Rambo arrest three pipo wey dem suspect dem be thief, Ole railway vandal syndicate, and dem recover stolen railway tracks of N200 million for Surulere Local GOyo ornment Area. Police tuk, tuk person, Olayinka Ayanlade, tuk say na tip-off from one sharp-eyed residentnaim dem take run di package. According to police, early investigation show how dem take thief di track from Niger before dem […]

todayJuly 15, 2026 8

Lagos

Lagos Gornment kramp Man Wey Dump Dirty for Drainage

BY Esther Daniel Lagos State Gornment don arrest one 56-year-old man, John Ehidreme, say im allegedly go thruway dirty for gutter for No. 18 Oluoga, Ikorodu. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say officials catch the man on Tuesday as government dey step up enforcement of environmental sanitation laws. The arrest come after one video spread online wey show one security guard dey pour refuse from dustbin […]

todayJuly 15, 2026 12 1

OBODO NAIJA

Atiku tuk say make dey check Gbajabiamila Over Corruption Allegation

BY Esther Daniel ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don call for independent investigation into corruption allegation wey dey against President Bola Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila. Atiku say nobody suppose dey above the law and make government investigate the matter properly to allow Gbajabiamila defend himself. E add say gornment no fit claim say e dey fight corruption if top officials no dey held accountable too.

todayJuly 15, 2026 11

Sport Yarns

Ashe Declare Say E Don Set For 2026  Commonwealth Games

By : Jolayemi Olajide Nigeria sprint star, Favour Ashe, don rake to boost moral  say e don ready mentally and physically for the 2026 Commonwealth Games wey go happen for Glasgow, Scotland. Ashe, wey people sabi as "The Nigerian Nightmare," say Team Nigeria training camp  dey hot wetin nor gud and  dat confidence high. Di  100 metres and 4x100 metres relay specialist explain say di training don put the team […]

todayJuly 15, 2026 12

Sport Yarns

Spain Shock France, Enter World Cup Final

By : Jolayemi Olajide Spain don shock World Cup favourites, France, beating dem  2-kondo victory on Tuesday to book dia place for the final of di tournament. Mikel Oyarzabal first-half penalty and Pedro Porro second-half goal naim hellep di European champions secure the win for AT&T Stadium, Texas. Spain, wey win the World Cup for 2010, go now face either Argentina or England for Sunday final in New Jersey.

todayJuly 15, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds