Blog sidebar

Background

National

Vice Presido Shettima Beg Nigerians

Vice Presido, Kashim Shettima dey shout for one coner, dey pray for Abuja National Mosque on Friday, say make Nigerians drink cold water, chillas, call for peace, to take celebrate dis year Democracy Day on June 12. After di prayer, Shettima assure Nigerians say Presido, Bola Tinubu dey work oh, say dat man work hard pass rock of ages, all na to bring stability to di country. Shettima say, all […]

todayJune 8, 2026 10

Lagos

Lagos Gornment Share Bulletproof Vests And Helmets

Lagos State Security Trust Fund (LSSTF) don share bulletproof vests and heavy-duty helmets give all Divisional Police Officers (DPOs), Area Commanders, and tactical squad for di state. Di LSSTF boss, Dr. Ayodele Ogunsan, naim hand over di security gear on Friday base on di order of baba govo, Babajide Sanwo-Olu to take protect di police officers as dem dey fight crime. Ogunsan say dis support na to clear doubt say […]

todayJune 8, 2026 12

Sport Yarns

Ronaldo And Messi Wan Make History With 6th World Cup

By : Jolayemi Olajide Football legends Cristiano Ronaldo and Lionel Messi na im dey headline di list of global superstars wey go feature for di 2026 FIFA World Cup wey Canada, United States and Mexico go co-host. According to information wey MSN.com publish on Friday, di big tournament go feature 48 national teams and plenty established stars alongside rising football talents from around di world. Ronaldo, wey be Portugal captain […]

todayJune 5, 2026 41

Sport Yarns

 Tottenham Grab Andy Robertson for  Free

By : Jolayemi Olajide Tottenham Hotspur don complete the signing of Scotland captain Andy Robertson for  free transfer. BBC Sport report on Friday say the 32-year-old left-back go join the North London club on July 1 after im contract with Liverpool expire. Robertson don bin  announce say e go leave Liverpool dis summer, and na dia  Tottenham  take collobi im signature.

todayJune 5, 2026 10

obodo oyinbo

Hamas declare Say Dem No Dey Surrender Weapons, but dey ready peace tuk

By : Jolayemi Olajide Hamas political senior man, Husam Badran drop micro soft word, say dem ma ready for peace tuk with  Gaza, as dem still dey negotiate peace plan. Im yarn dis one for TV interview, but dat one nor mean say Hamas go surrender weapons. Acoording to Husam,  Wahala still dey for  di negotiation as different Palestinian groups dey prepare for Cairo meeting,while Isreal sti dey drop tins […]

todayJune 5, 2026 13

OBODO NAIJA

Abuja Police Seize Over 30  Cars say dem get black glass

By : Jolayemi Olajide FCT Police Command don seize more than 30 vehicles with tinted glass, wey be say dem cover plate, say any motor wey nor get correct registration go collect based on di insecurity. According to di  FCT Commissioner of Police, Ahmed Sanusi, say nao ga IGP, Olatunji Disu, give dem dem di go ahead and to tackle rising cases of one-chance robbery, kidnapping and other violent crimes. […]

todayJune 5, 2026 14

Politics

INEC Stand Ground say any  Primaries wey nor follow timetable, Otilor

By : Jolayemi Olajide   INEC don warn political parties say any primary election wey dem do after May 30 deadline no go  count oh, except higher court cancel the earlier judgment. National Commissioner Mohammed Kudu Haruna naim package for statement on Friday, say parties suppose still follow the Electoral Act 2026 until Court of Appeal decide on INEC appeal. Dis  mata sef sup based on one Federal High Court […]

todayJune 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Atiku Drag Tinubu Again Over Oyo Kidnap Victims

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don tackle Presido, Bola Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu over the continued kidnapping pupils and teachers  for Oyo State. For statement wey im media aide, Phrank Shaibu, release on Friday, Atiku accuse di Federal Gornment of failing to show enough energy to rescue di victims. Di African Democratic Congress presidential candidate say e dey difficult to understand why gornment still […]

todayJune 5, 2026 11

OBODO NAIJA

NCDC Raise Red Alert, Say Ebola Fit Enter Naija Anytime

By : Jolayemi Olajide Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC, don make am clear say Ebola Virus Disease entering Nigeria dey very high cause e dey spread Uganda and Democratic Republic of Congo. NCDC Director-General, Dr Jide Idris, naim sorosoke dis announcement during media briefing for Lagos as e explain Nigeria preparedness level against di disease threat. According to am, as e dey increase for international, movement of […]

todayJune 5, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Join Body With FAO to Fight Birdflu Out

By : Jolayemi Olajide Federal Gornment don join body with Food and Agriculture Organization, FAO, to block and fight bird flu virus inside di country with $350,000 cash. Di Ministry of Livestock Development naim yarn dis one on Thursday night say di cash go train 240 animal health workers to trace di sickness. Dis new project go help upgrade lab setup, track animal diseases, and make sure say information dey […]

todayJune 5, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds