Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Naija Collect $9.5M from Jersey – Govt Yarn

By: Esther Ayoola Authorities for Jersey, British Crown Dependency wey dey between UK and France, yarn say dem go return over $9.5 million (£7 million) wey belong Nigeria government. Attorney General for Jersey, Mark Temple KC, tuk say di money go dey used for infrastructure projects across Nigeria. Him yarn dis one follow Memorandum of Understanding wey dem sign with Nigeria government for December. Dis repatriation na continuation of past […]

todayJanuary 9, 2026 3

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 6

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 7

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 10 2

National

Kwankwaso: I Go Only Join Party If Dem Give Me Top Slot

By: Esther Ayoola National leader of di New Nigeria Peoples’ Party (NNPP), Senator Rabiu Musa Kwankwaso, don say e go only join any political party for 2027 election if dem offer am presidential or vice-presidential ticket. Kwankwaso tuk dis one on Thursday during one Kwankwasiyya gathering wey hold for im residence for Miller Road, Kano, while e dey address ongoing political realignments ahead of di next general elections. E explain […]

todayJanuary 9, 2026 10

Lagos

I No Get Rift With Abiodun – Govo Sanwo Olu

By: Esther Ayoola Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu, don come out clear tuk wey no true on top beef marras between am and Ogun State govrnor, Prince Dapo Abiodun. Na lie lie tuk, according to am. Di Govo yarn di tori straight for statement wey im media oga, Gboyega Akosile, drop yesterday. Sanwo-Olu con yarn say, make people calm down because nothing like dat dey happen at all, say both […]

todayJanuary 9, 2026 8

obodo oyinbo

Turkish Airlines No Dey Fly Tehran Again As Iran Protest Dey Hot

By: Esther Ayoola Turkish Airlines don cancel five Friday flights wey suppose go Tehran, Iran, afta di city don dey rocked by protests over rising living cost, di Istanbul Airport app report on Thursday. Di airport app also show say five oda  flights wey Iranian airlines dey operate don cancel, while seven others still dey go ahead as scheduled. Turkish authorities never comment on di situation yet, wey dey happen […]

todayJanuary 9, 2026 4

National

Ogun Teen Drown Die for Swimming

By: Esther Ayoola Ogun State Police don call for better safety for all recreational centres and swimming pools across di state after 17-year-old boy drown die. Police Public Relations Officer, Babseyi Oluseyi, tuk dis one on im X page on Wednesday, say di warning dey follow recurring drowning incidents for Ogun. Di police spokesman explain say di teenager lose im life during one recent swimming-related accident, wey happen inside di […]

todayJanuary 9, 2026 8

Sports

New Chelsea Boss Rosenior Face FA Cup Test

By: Esther Ayoola Liam Rosenior go start im first match as Chelsea manager dis weekend when e carry di Blues go face second-tier Charlton for FA Cup third round. Di FA Cup match dey tagged risky, as football pundits warn say small clubs fit shock big teams anytime. Tottenham manager Thomas Frank dey London dey fight to save im job, afta di team show poor form for Premier League. Meanwhile, […]

todayJanuary 9, 2026 6 1

National

I No Declare Presidential Race – Datti Baba-Ahmed

By: Esther Ayoola Former vice-presidential candidate of Labour Party,  Datti Baba-Ahmed,  don clear air say e never declare interest to contest presidency. E tuk dis one on Friday during one media sitdon tuk tuk, say some people twist wetin e tuk. According to am, e no make any announcement at all; e just tuk say e still dey inside Labour Party. E explain say di clarification come because political speculation […]

todayJanuary 9, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app