Blog sidebar

Background

National

El-Rufai Show Face For Court As Im Bail Mata Continue

By: Esther Ayoola Former Kaduna governor Nasir El-Rufai don show face for Federal High Court Kaduna dis morning around 9 o’clock as dem continue hearing for im bail matter. Say di Court dey under heavy security as police and Department of State Services officers full everywhere. Yesterday, Justice Rilwan Aikawa shift di case because defence and prosecution lawyers get some legal wahala to settle. El-Rufai lawyers first tuk say make […]

todayApril 1, 2026 14

National

Doctors Threaten To Enter Strike Over Colleague Attack For Ogun

By: Esther Ayoola Nigerian Association of Resident Doctors don raise alarm on Tuesday say danger don dey increase for health workers safety for Naija. For statement wey dia Presido, Mohammad Usman Suleiman, sign, dem say, di latest attack hapun for Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital. NARD condemn di act, say di attack na shocking and barbaric act wey violate human dignity and endanger doctors for work.   Dem explain say […]

todayApril 1, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment Tell Dia Childresis To Report Emergencies To 767, 112

Lagos State Gornment don train over 1,000 students on how to use emergency numbers 767 and 112. Say na di Lagos State Command and Control Centre organise dis parrol dey tell di students across di obodo Lagos For statement wey dem release on Wednesday, wey LSCCC, Head Public Affairs, Yemisi Sule sign, say di training na part of effort to improve emergency preparedness and responsible behaviour. She sti add say […]

todayApril 1, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Revolutionary Guards Threaten Apple, Google, Tesla If More Leaders Kpai

Iran Revolutionary Guards like dis, don cut chain say if more of dia top Iranian leaders kpai sake of dis war, dem go target big US tech companies like Apple, Google, Meta, Microsoft, Tesla and others. Say dem drop microsoft word for di workers for these companies make dem avoid office starting Wednesday 8:00 pm Tehran time to save dia life. Di Iran guards dey claim say, these companies dey […]

todayApril 1, 2026 12

OBODO NAIJA

House of Rep Pass N68.3 Trillion 2026 Budget

House of Representatives for Abuja don pass di 2026 Appropriation Bill wey go spend N68.3 trillion. According to House Leader Prof. Julius Ihonvbere, say dis budget go favour  development more dan consumption and make capital spending pass recurrent spending for di first time. U sabi say, di approved budget, wey Presido Bola Tinubu propose last year, include over N26 trillion for roads, power, and other projects, N5.4 trillion for security, […]

todayApril 1, 2026 13

OBODO NAIJA

Senate Approve Tinubu $6bn Loan To Fix Ports, Cover Budget Gap

Senate don approve oga Presido Bola Tinubu request to borrow $6 billion from outside. Chairmo of di Senate Committee on Local and Foreign Debts, Senator Aliyu Wamakko, clear dis mata say, Tinubu write two separate letters to Senate Presido, Godswill Akpabio, asking $5 billion from Abu Dhabi Bank for budget deficit and old debts, and $1 billion from UK Export Finance through Citibank London to fix Lagos and Tin Can […]

todayApril 1, 2026 11

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Meet Ganduje, Badaru As Kano, Jigawa Politics Dey Shake Up Ahead 2027

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu don meet former Kano govo, Abdullahi Ganduje and ex-Defence Minister Badaru Abubakar for Aso Rock as politics dey shakeup for Kano and Jigawa. Though wetin dem discuss never come outside, pipo believe say na plan to make All Progressives Congress strong again for di states. For Kano, mata  hot, as Rabiu Musa Kwankwaso and im supporters dump New Nigeria Peoples Party go join All […]

todayApril 1, 2026 13

Lagos

LIRS Extend Tax Return Deadline To 14 April

Lagos State Internal Revenue Service (LIRS) don extend di deadline for individual annual tax returns from 1 April go 14 April 2026. Di Head of Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, na im tuk dis one for statement, say dem do dis to give pipo more time to complete di tax returns process. You sabi say, di federal gornment don already say every Nigerian gatz file tax returns by 31 March under […]

todayApril 1, 2026 21

National

Court Adjourn El-Rufai Corruption Case Again

Say nor be small gbege for court as Former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai show face for Federal High Court for Kaduna on Tuesday over alleged corruption case wey ICPC carry come. During di sitting, na so Rufai lawyer, Ukpon Akpan, cut chain follow Justice Rilwan Aikawa say make im step aside for di case dat di judge dey bias but later withdraw di request. Based on di jogolo, di […]

todayMarch 31, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds