Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

How First Lady Oluremi Tinubu Land Ogbonge Award For Heath Mata

By: Esther Daniel Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don receive di Diaspora Health and Humanity Champion Award for di 2026 National Diaspora Merit Awards, wey hold on Sunday. Say dis award na to thank iya kulikuli based on one or two wey she contribute to health and humanitarian development matas for di obodo naija. Na Wife of di Vice Presido, Hajiya Nana Shettima, naim carry her mouth tuk thank […]

todayJuly 27, 2026 20

Lagos

NDLEA Gbab Balogun Market Trader Over Cocaine

By: Esther Daniel National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don gbab 55-year-old Lagos businessman, Onuigbo Chinedu, over alleged attempt to export 3.30 kilograms of cocaine wey dem hide inside food cartons wey dey go United Kingdom. NDLEA tuk, tuk, Femi Babafemi, konfam say, dia officers do di arrest for Murtala Muhammed International Airport, Lagos, last weekend. Babafemi explain say three cargo agents wey handle di shipment—Nkwor Onyekachukwu Justina, Adeleke Abiola […]

todayJuly 27, 2026 17

OBODO NAIJA

Enugu Air CEO Clear Air On Top Di Benin Airport Incident

Chief Executive Officer of Enugu Air, Captain Tolu Ita, don clear di air say di recent runway incident for Benin Airport no be plane crash or emergency landing, as all passengers and crew members come out safe. For video wey di airline post on Friday, she tok say di aircraft slide comot from runway after e hydroplane during landing, but nobody sustain injury or die. She explain say di plane […]

todayJuly 24, 2026 28

Entertainment

Cardi B Tok Say Any Son Wey Giv Girl Belle Go Comot for House

American rapper Cardi B don tok say if any of her sons giv girl belle, na di same day na im go tell am make e comot for house. For one video wey she share, Cardi B tok say anybody wey make adult decision suppose ready to carry adult responsibility. She add say her son go need find work, stand on im own financially and take responsibility for wetin e […]

todayJuly 24, 2026 32

OBODO NAIJA

2027 Fit Enter Trouble! INEC Chairman Demand Financial Freedom For Electoral Body

By: Yusuf Abuh INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, don warn say free, fair and credible 2027 elections fit dey difficult unless di electoral body get full financial autonomy, as e tok during one book launch for Shehu Musa Yar'Adua Centre, Abuja, say, "If we are serious about strengthening our institutions and conducting free, fair and credible elections, then financial autonomy is essential." Amupitan explain say although di Constitution place INEC […]

todayJuly 24, 2026 18

OBODO NAIJA

OBASANJO DROP BOMBSHELL! Say Atiku Allegedly Give Na’Abba ₦5 Million To Start Impeachment Plot

By: Yusuf Abuh Former Presido Olusegun Obasanjo don allege say im former Vice Presido, Atiku Abubakar, give late House of Representatives Speaker Ghali Na’Abba ₦5 million to kick-start impeachment plot against am during dia first term in office. Obasanjo make di allegation through one statement while replying former Ogun State Gofnor Olusegun Osoba over political events wey lead to di 2003 general elections. Di former Presido claim say Atiku invite […]

todayJuly 24, 2026 19

OBODO NAIJA

Atiku Fire Back! Say Obasanjo Dey Play Politics With Old Impeachment Story

By: Yusuf Abuh ADC presidential candidate and former Vice Presido Atiku Abubakar don reject former Presido Olusegun Obasanjo allegation say e give late House Speaker Ghali Umar Na’Abba money to begin impeachment plot against am, as im media aide Phrank Shaibu release statement on Friday describe di claim as political game ahead of 2027 election. Atiku tok say di allegation na attempt to spoil im name and give unfair political […]

todayJuly 24, 2026 23

Lagos

Thieves Don Meet Dia Match! FG Deploy Coastal Guards To Protect Lagos-Calabar Highway

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don deploy 40 Coastal Guards to protect di Lagos-Calabar Coastal Highway from vandals, as Federal Controller of Works Olufemi Dare launch di security team for Lagos on Thursday. Olufemi Dare tok say di move become necessary because criminals dey steal manhole covers and vandalise road facilities along di highway. Di Federal Gornment equip di guards with tracked bikes and other patrol equipment to help dem […]

todayJuly 24, 2026 19

OBODO NAIJA

America Don Enter Kanu Matter! US Congressman Demand Make Nigeria Free IPOB Leader

By: Yusuf Abuh US Congressman John James don call on Nigerian gornment to release IPOB leader Nnamdi Kanu, as e make di demand on Thursday during proceedings for Washington, D.C. Di Michigan lawmaker tok say Kanu continued detention raise serious concern over religious freedom and human rights, urging Nigeria to respect international legal standards. James also refer to im resolution before di US Congress, saying di move aim to pressure […]

todayJuly 24, 2026 12

Lagos

Lagos Don Set For Mega Projects! Assembly Approve ₦200 Billion Bond

By: Yusuf Abuh Lagos State House of Assembly don approve request make di state gornment borrow ₦200 billion bond to fund major infrastructure projects, as lawmakers give di green light during plenary for Ikeja on Thursday. Chairman of di Joint Committee, Sa’ad Olumoh, present di committee report after members examine di executive request and recommend say make dem approve am. Commissioner for Finance, Abayomi Oluyomi, explain say di bond go […]

todayJuly 24, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds