OBODO NAIJA

Obi Ginger Oga Presido Tinubu To Dey One Side For Beta Leader To Rule Naija

todayJuly 27, 2026 5

Background
share close

By: Esther Daniel

Labour Party presidential candidate for 2023 election, Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu again, say make wi presido step aside dat im nor get di doings to solve naija security wahala.

Obi yarn dis one for tv sitdown tuk on sunday, dat baba need rest oh.

E still tok say no mata how many governors support Tinubu for 2027 election, na hungry and suffering Nigerians go decide who go win.

Obi come maintain say na im win di 2023 presidential election and call on Federal Gornment plus INEC to make sure say 2027 election free, fair and credible.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds