Blog sidebar

Background

National

Adebayo Adelabu Deny Resignation Rumour

By: Esther Ayoola Oga minister of Power, Adebayo Adelabu don deny report say im resign to go contest for Oyo state 2027 governorship election. Oga Adelabu tuk dis one for TV sit down tuk say di news wey don go viral for social media na fake, as e never write any letter to step down. Adelabu explain say e stl dey focus on im work as Minister of Power, but […]

todayApril 1, 2026 14

Sports

Victor Boniface Return to Full Training, Fit Play Before Season Finish

By: Esther Ayoola Say Victor Boniface dey happy happy wetin nor good dat im don return back to full fitness afta missing for month sake of wunjury. Di Naija player do knee surgery for January, and people think say e no go play dis season again. But now, Boniface don start training dis week, and e fit even play for Bremen before season finish. Di 25-year-old wey join Green and […]

todayApril 1, 2026 13

National

IGP Disu Lead Nationwide Police Walk To Build Trust, Promote Fitness

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Olatunji Disu, don lead go lead one gonge nationwide walkathon yesterday wey involve senior officers, rank-and-file police, and members of di public as part of police week celebration. Say dem start di waka for Abuja from Force Headquarters go Unity Fountain. Untop yarnings with tori pipo, di senior man, Disu explain say na to display di spirit of di Naija police force […]

todayApril 1, 2026 9

Lagos

Lagos LG Chairmen Back Gov Sanwo-Olu Monthly Clean-Up Exercise

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don get support from all 57 LG/LCDA chairmen for di monthly environmental sanitation wey dem don bring back. Di mata follow one meeting wey some State Executive Council members hold with di council chairmen for Alausa, Ikeja. Oga Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, make every tin clear for di meeting say e go make state and local government collabo to keep Lagos clean and […]

todayApril 1, 2026 20

obodo oyinbo

Israel Hit Lebanon Hard, Kpai Top Hezbollah Commander

Say like dis Israel don increase dia attack for Lebanon dis week, hitting places outside Hezbollah on Tuesday. According to reports, Dem strike one vehicle north of Beirut plus Jnah area for di middle of di capital. For di south and di suburbs, wey Hezbollah strong, dem sti dey hit places; one building for road to Beirut airport collapse afta dem evacuate di pipo wey dey inside. Israel say dem […]

todayApril 1, 2026 24

obodo oyinbo

Italy Sport Minister Tell Italy Football Ogas To Resign

By: Esther Ayoola Italy Sport Minister Andrea Abodi like dis don wire di head of football federation to resign afta Italy miss World Cup again. Italy lose for play-off to Bosnia-Herzegovina and no enter di USA, Canada, Mexico World Cup dis summer. Football oga , Gabriele Gravina tuk say e no wan resign, but di board go meet next week to decide im marras. Abodi dey insist dat dem need […]

todayApril 1, 2026 16

Sports

Chelsea Make Premier League Record Loss of £262m

By: Esther Ayoola Say Chelsea don record one kain big loss for Premier League, dat dem loss £262.4 million ($349.3 million) before tax for di last year wey end June 30, 2025. According to experts, say dis record pass di one wey Manchester City get for 2010/11 wey be £197.5 million. Last year, Chelsea bin make profit of £128.4 million because dem sell dia women team to Blueco Midco for […]

todayApril 1, 2026 13

National

Fear Return For Jos Afta Plateau Curfew Lift

By: Esther Ayoola Tension don burst for Jos, Plateau State again, few hours afta di gornment commot dia 48-hour curfew wey dem put afta di Sunday night attack for Anguwan Rukuba. Eyewitnesses tuk say small-small wahala don start again for different part of Jos, however no bad report say person wunjur or kpai yet. Traders wey just start dia business today run because of fear, as everywia dey rowdy. Plateau […]

todayApril 1, 2026 15

National

Court Clear Turaki, PDP Chairman Arrest Warrant

One ogbonge Abuja High Court on Wednesday don vacate di bench warrant wey dem issue for March 26 for Kabiru Turaki, a factional PDP National Chairmo. Turaki appear for court today, tuk say e return from outside di country, na him lawyer, Chris Uche SAN, yan am wetin dey play. Uche apologise to court say both him and Turaki dey respect court mata wella. Justice Peter Kekemeke grant di request […]

todayApril 1, 2026 16

National

EFCC Nab Abuja Agent Over N288m Fake Property Deal

Economic and Financial Crimes Commission don arrest one Abuja house agent, Hajia Adama Adamu, over alleged property scam of N288 million. EFCC tuk say dem catch Adama Adamu  tru dia  Ilorin zonal officers afta person send petition complain. Dem say, she collect di money from one Alhaji Tanko Yawale, promise say she go help am buy property for Abuja. But afta she collect di money, EFCC say she no fit […]

todayApril 1, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds