Lagos

784 Results / Page 24 of 88

Background

Lagos

Lagos Go Close Apongbon Bridge For Six Weeks For Repairs

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment, don join body with Federal Ministry of Works, don announce say dem go start repairs for failed asphalt parts of ramp and service lane wey connect Inner Marina to Apongbon Bridge, plus some parts of di bridge lanes. State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, tuk say di work go start for service lane on Thursday, February 5, and e dey expect say e go […]

todayFebruary 5, 2026 10

Lagos

LAWMA Arrest Man Throwing Dirty Wey Smell Reach Gorment House LAWMA

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don arrest one man for Lagos Island early Tuesday mor mor, say im thruway dirty wey smell reach gorment house. Say dis operation na part of dia effort to stop pipo wey dey throw dia dirty anyhow for di area. According to a statement for di lagos state gorment official website, di man, wey dem identify as Muritala Suleiman, 42 years old […]

todayFebruary 4, 2026 6

Lagos

Lagos Assembly Give Order To Stop Makoko Demolitions

By: Esther Ayoola Lagos State Assembly don meet Makoko people wey demolition affect on Monday for Lagos, to address di wahala wey di demolitions dey cause. Chairmo of House Committee on Makoko Demolition, Majority Leader, Noheem Adams direct say, make all ministries and agencies stop demolition for Makoko, Oko-Afon, and Shogunro, to prevent more community stress. Adams say, moving forward, lawmakers go waka go di area to check wetin dey […]

todayFebruary 3, 2026 13 12

Lagos

Lagos Targets Measles, Rubella With New Statewide Elimination Plan

By: Esther Ayoola Di Lagos state gorment one week war against Measles-Rubella (MR) and Routine Immunisation (RI) Campaign  don dey finally end officially 5 February, 2026. Na January 27, 2026, wey First Lady of Lagos State, Dr.  Ibijoke Sanwo-Olu flag off di campaign sending her disciples to various primary health centres across di state for di different local gorment area. According to report dis campaign sef dey measure shoulder with […]

todayFebruary 3, 2026 14 20

Lagos

Makoko House Demolition Palava Reach Lagos House Of Assembly

By: Esther Ayoola Lagos State Waterside Community residents wey dia houses face demolition by Lagos State Gornment don carry dia mata go meet members of di Lagos State House of Assembly, to find solution on di way forward. Konfam News waka-waka reach di State House of Assembly for Alausa, Ikeja on Tuesday morning by 10am, and dem report say di meeting start few minutes before 11am. Just before di meeting […]

todayFebruary 3, 2026 6

Lagos

Sanwo-Olu Call Foreign, Local Investors For Business

By: Esther Ayoola Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, don wire ogbonge call to local and foreign investors to come do business for Lagos, say di state ready to do collabo, so far na business. Sanwo-Olu yarn dis one for Nigeria–UAE Investment Forum wey dem call Investopia Global Africa, wey Shelle for Victoria Island. According to baba govo, say na senior investors na put bodi for the forum and dat once […]

todayFebruary 3, 2026 17

Lagos

Lagos Gorment Promise Makoko Community Beta Life

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don repeat tuk, say dem go still upgrade Makoko community for Lagos Mainland, and dat, dem nor get plan to scatter pipo community. Say, Dem don put $2 million as dia own share for di project, and dem dey wait for another $8 million from United Nations to start work. Special Adviser to Governor on eGIS and Urban Renewal, Dr Babatunde Olajide, ni dey […]

todayFebruary 3, 2026 8

Lagos

Lagos Govt Carry Mobile Court Enter Road, Teach Pipo Traffic

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don carry Special Offences (Mobile) Court waka go different parts of di state to sensitize people on traffic and environmental laws. Di programme wey hapun Friday for Lagos Safety Arena and areas like Oshodi, Iyana Ipaja, Ojota and Ikorodu na to teach people make dem obey law. Dem focus on one-way driving, misuse of BRT lane and blocking public spaces. State Attorney-General, Lawal Pedro […]

todayFebruary 3, 2026 12

Lagos

Lagos Emergency Share Report Say Na 173 Pipo Kpai From 1,156 Emergency For 2025

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency don drop update say na 173 people ni kpai from 1,156 emergencies wey hapun for 2025. Road crash wey hapun pass 394 cases, followed by tanker and truck wahala of about 249, and fire out break reach 204. February na di month wey get di most palava with 122 cases, while Alimosho local government top di chart with 180 emergencies. According to […]

todayFebruary 3, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds