Lagos

Two Trucks, One Car jam each oda  for Gbagada Lagos State Traffic Management Authority

todayJune 29, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Nor drive wawa, wawa, pipo nor dey hear for di obodo lagos oh, like dis now  Lagos state Traffic pipo, don konfam one serious motor askident wey hapun for Monday morning inside  Gbagada along di express.

According to LASTMA, di askident involve two big trucks wey carry cargo and one private car, gbowayi, dem jam demselves.

Di agency say emergency responders and tow truck don reach di scene and recovery operation don start to clear di road.

LASTMA sha dey advise motorists make dem nor drive wawawa  and expect traffic as officials dey work to restore free movement.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds