Lagos

1135 Results / Page 5 of 127

Background

Lagos

Lagos Passenger Jump Out From Moving Bus Kpai Himself

By: Mariam Ajayi One passenger go jump comot inside moving commercial bus con kpeme, say di bus get askident go jam  iron pole for  Ojuelegba for Lagos State. According by di Lagos State Traffic Management Authority oga Adebayo Taofiq, for statement wey im wrap like moimoi, say di  driver drink alcohol con dey drive wahwahwah. Taofiq say na based on di Driver wawa  driving naim make di motor get askident […]

todaySeptember 28, 2026 13

Lagos

Elites Lions Club Support Kosofe Students With School Things

By: Mariam Ajayi Lagos Elites Lions visit Kosofe Junior High School for Ketu-Alapere, Lagos on Thursday, 24th of September, 2026 to support students and promote reading. Di club organize school-support and literacy programme to encourage di students make dem take dia education serious. Dem also donate books and oda school materials to help di students for dia studies. Di programme also include motivation to encourage di students make dem read […]

todaySeptember 25, 2026 25

Lagos

Lagos Gornment Bring Better Policy Wey Go Stop SGBV

Lagos State Gornment don carry new style enter mata, bring ogbgongelicious law way dem wan use rasckal sexual and gender based violence. Na area  Mama of  Lagos, first lady,  Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, carry mata for head power dis law  on Thursday, she porporly marras say, di  policy na proper jazz to hold wicked for pipo neck for house, school, and office. To tell how e serious reach, Ibijoke carry microphone  […]

todaySeptember 25, 2026 19

Lagos

Lagos Govment Wan Deal With Sexual Violence Offenders

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don carry new style enter mata,  bring ogbgongelicious law way dem wan use rasckal sexual and gender based violence Na area  Mama of  Lagos, first lady,  Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, carry mata for head power dis law  on Thursday, she porporly marras say, di  policy na proper jazz to hold wicked for pipo neck for house, school, and office. To tell how e serious reach, […]

todaySeptember 25, 2026 15

Lagos

Lagos Gornment Gbab One Man Wey Allegedly Abuse Toddler

Lagos State Gornment don confirm say police don arrest one man wey dem accuse of abusing one small pikin for Ikorodu, as e dey police custody while investigation dey go on. Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency, DSVA, say dem arrest di suspect on Wednesday, September 23, 2026, one day after dem alert di agency about di viral report of di alleged child abuse. DSVA say immediately dem receive […]

todaySeptember 24, 2026 16

Lagos

Suspected Cultists Kpai One Man For Ikorodu

By: Mariam Ajayi Suspected cultists allegedly , don go kpai persin, wey name na  Tosin.  after dem rob am for Egbin area of Ijede, Ikorodu, on Tuesday, September 15. Tosin reportedly, just  travel from Ondo State come attend one event for the community, as im just comot di party go one side na dis badness hapun. According to  source say some Jagudas  allegedly attack am, collect im gold chains, mobile […]

todaySeptember 23, 2026 16

Lagos

Lagos Gornment Promise Safer Schools For Childrensis

Lagos State Gornment say e dey renew im commitment to make sure say, schools dey safe for childrensis and protect dem from abuse, fear and other forms of jaguda. Na di Commissioner for Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Hon. Jamiu Tolani Alli-Balogun, tok dis one on Tuesday, September 22, saying schools suppose be places where childrensis dey feel safe, valued and protected as dem dey learn and […]

todaySeptember 22, 2026 14

Lagos

Police Gbab Suspected Cultist For Ikorodu

Di Lagos State Police command don gbab one suspected cultist, 36-year-old Muyideen Olatunbosun, during anti-crime patrol for Idi-Iroko, Ogolonto and Agric area of Ikorodu. Police gbab am as dem dey do patrol for that side, collobi better informate on top some doings,  kon stop and search di suspect body, na so dem see one rubber-made pistol, one axe, criminal charms and one hard drug wey dem call “Ice”. Di suspect […]

todaySeptember 22, 2026 17

Lagos

Lagos Draw Ear Give Residents Say Fake Palm Oil Dey Outside

By: Ayobami Dada Lagos State Consumer Protection Agency (LASCOPA) don warn residents make dem dey careful when dem dey buy palm oil, as people don dey use more  ways to mix fake things inside am. Di agency give di warning on Monday after Dr Nurah Oseni from Auchi Polytechnic present research on palm oil adulteration for Lagos State Food Safety Conference and Exhibition 2026. Oseni say palm oil easy to […]

todaySeptember 22, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds