Lagos

988 Results / Page 54 of 110

Background

Lagos

Lagos Gorment Meet Doctors To End Strike

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment say dem ma dey do everytin within dia power to resolve issues wey dey behind di ongoing strike by di Joint Health Sector Unions (JOHESU) in di state. Di Permanent Secretary, Lagos State Primary Healthcare Board, Ibrahim Mustafa, yarn dis one for interview on Sunday. Mustafa say, gornment sabi say problem dey for di health sector and dat, dem ma dey dialogue to […]

todayJanuary 12, 2026 11

Lagos

Chimamanda Lawyers Drag Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Solicitors wey dey represent Nigerian senior writer Chimamanda Adichie don write letter to Euracare Multi-Specialist Hospital, Lagos, over di death of her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, wey die on Wednesday, January 7, 2026. Di lawyers,  Prof Kemi Pinheiro (SAN), claim say di hospital, di anaesthesiologist, and attending medical staff breach di duty of care wey dem suppose give di pikin. Lagos State Gornment don confirmate say dem […]

todayJanuary 12, 2026 22 34

Lagos

Chimamanda Adichie Drag Lagos Hospital Over Pikin Death

By: Esther Ayoola Senior Nigerian writer, Chimamanda Adichie, don drag one private hospital for Lagos, Euracare, say make dem come answer for wetin happen afta her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, kpai for di hospital. Her Mata sef dey raise worries about di hospital as plenty, plenty pipo sef dey accuse di hospital of medical negligence and professional misconduct. Say, like dis, Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don also order investigation […]

todayJanuary 12, 2026 19

Lagos

Lagos Gorment Release Plan For Waterside Business

By Ebi Oboko Lagos State  gorment don release new plan say, dem wan turn all   watersides for  di state to beta business wey go bring state  money. Based on yanings with tori pipo,  Di  Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tuk say, dis new policy go hapun dis  2026 and say, e show beta workings for  2025. Before now, say  people dey buy land dem for di waterside, dem […]

todayJanuary 12, 2026 25 4

Lagos

INEC Chair Swear Say E No Go Be Magomago, Tech Go Run Am

By: Esther Ayoola Prof. Joash Amupitan (SAN), Chairman of INEC, yarn on Friday for Lagos during di 2026 Induction and Strategic Retreat say 2027 General Election go free, fair, transparent and dey run with technology. Im tuk say commission no go tolerate any misconduct to make sure election clean. Amupitan explain say INEC dey prepare for how election dey change fast and wan meet expectations of Nigerians. Di retreat wey […]

todayJanuary 9, 2026 17

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 19

Lagos

I No Get Rift With Abiodun – Govo Sanwo Olu

By: Esther Ayoola Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu, don come out clear tuk wey no true on top beef marras between am and Ogun State govrnor, Prince Dapo Abiodun. Na lie lie tuk, according to am. Di Govo yarn di tori straight for statement wey im media oga, Gboyega Akosile, drop yesterday. Sanwo-Olu con yarn say, make people calm down because nothing like dat dey happen at all, say both […]

todayJanuary 9, 2026 21

Lagos

Lagos House Of Assembly Don Pass ₦4.4 Trillion Budget For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don pass di ₦4.4 trillion 2026 Budget of Shared Prosperity enter law. Committee chairmo, Hon. Sa’ad Olumoh, present di breakdown for plenary on Thursday. Di budget get ₦171 billion increase and focus on roads and infrastructure, education, healthcare, economic growth and social development. According to di report, dis na third budget of di present administration and di final new-cycle budget for Governor […]

todayJanuary 9, 2026 31

Lagos

iPhone Scam: Lagos Police Catch Woman for 500 Million Scam

By Ebi Oboko Lagos police command share update on wetin dey play for tech business for di obodo naija, say dem don arrest one 35-year-old woman, Modupeola Bamisade, for allegedly scamming over 100 people of more than N500 million. The Lagos State Police Command say she dey sell iPhones, iPads and other Apple products online, dey offer 50 per cent discount to attract customers. According to Police source on Wednesday, […]

todayJanuary 8, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds