Lagos

988 Results / Page 52 of 110

Background

Lagos

Residents Scoop Diesel As Tanker Fall For Gbowai Apapa

By: Esther Ayoola Say nor be small traffic for Liverpool Bridge, Apapa, Lagos State on Monday, dat One diesel tanker fall gbowai for ground and na so resident carry keg dey go fetch di fuel for road, forgetting say e fit explode. Lagos State Traffic Management Agency (LASTMA) ni dey clear konfam news on Monday. According to LASTMA, dem don succeed divert di traffic to di other side of di […]

todayJanuary 19, 2026 16

Lagos

Two Kpai, Plenti Wunjor For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Esther Ayoola Say, nor be small gobe for area, at least two pipo say ni kpai on Sunday for Lagos-Ibadan Expressway, Kara Bridge side, near Mowe, afta some motors jam demsleves. According to di Lagos state Traffic management agency tuk tuk, Adebayo Taofiq, say di accident happen when one truck wey dey carry bags of flour lose control, ram several commercial buses and one parked Toyota Corolla, wey wunjor […]

todayJanuary 19, 2026 16

Lagos

Lagos Police Activate CCTV Centre To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command don activate CCTV Surveillance Centre to strengthen security for Lagos Island and nearby areas. Police Commisioner, Olohundare Jimoh, tuk say di centre go help police monitor activities beta and respond fast to any security threat. CP Olohundare Jimoh visit area for third mainland bridge, explain dat, dis one sef go make di catching of Jaguda boys go wiririwere, as dem go dey monitor […]

todayJanuary 19, 2026 24

Lagos

Sanwo-Olu Charge Lagos Councillors Make Dem Package Well For Grassroots Pipo

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don open onboarding and retreat programme for councilors for Lagos, tell dem make dem do dia touch lighting work with boldness. Govo Sanwo Olu gather di councillors from all 377 wards of Lagos for Lekki to train dem, share policy ideas, and guide dem on legislative work. Lagos state govo, wey im special advicer on environment, Olakule, Rotimi Akodu, represent, remind di […]

todayJanuary 19, 2026 15

Lagos

Lagos State Gorment Konfamate Dat No Person Kpai For Ikorodu School Classroom Collapse

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don Konfamate, say one classroom block for Odokekere High School, Ikorodu, Make Gbowai for ground, collapse, describing di incident as “sad news.” According to statement from di Special Committee on Rehabilitation of Public Schools (SCRPS) on Friday, nobody suffer wunjury and all di students dey safe. Di committee tuk say di building, di owners don bin already dey planned to demolish am, to make […]

todayJanuary 16, 2026 34

Lagos

Lagos Internal Revenue Service Drag Lagos Employers for Tax Returns

By: Esther Ayoola Lagos State Internal Revenue Service, LIRS, don dey drop  reminder again, dat make  all employers for Lagos ensure say, by January 31, 2026 make dem submit  dia tax returns for 2025 financial year. For statement wey office release, LIRS Chairmo, Dr Ayodele Subair, tuk say, di order, dey under Nigeria Tax Administration Act 2025, and employers must declare all workers’ pay and pay correct tax. Oga Ayodele […]

todayJanuary 16, 2026 19

Lagos

Makoko Residents Block Road Gorment Demolish Dia Building

By: Esther Ayoola Residents of Makoko, Ilaje Aiyetoro Community, Yaba, say nor be small matching dem do for Lagos State House of Assembly yesterday, block part of di road dey protest say gorment go demolish dia buildings. Di protesters, wey be affected residents, dey beg Lagos Gornment make dem limit di demolition to 100 metres, and dat if dey continue di way dem go, say plenty families go dey homeless. […]

todayJanuary 16, 2026 20

Lagos

Lagos Gorment Promise Beta Support, Security For Armed Forces

By: Esther Ayoola Following di spirit of 2026 Armed Forces Remembrance Day, Lagos State Gorment don promise oh, say e go continue to dey support armed forces members, whether dem dey alive or dead. Govo Babajide Sanwo-Olu, wey im deputy, Dr Obafemi Hamzat represent, tuk for Parade ground, say Lagos appreciate di sacrifice wey officers and men of armed forces dey make for di country. Im say di state dey […]

todayJanuary 16, 2026 19

Lagos

Omotaku: Lagos Task Force Catch Suspect Wey Attack Motorist For Road

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Environmental Taskforce and Anti-Crime Squad don arrest one suspected road gangster wey dem dey call Omotaku afta e attack motorist for Oshodi–Iyana Ipaja Road. Di gbege happen for Wednesday around 8:30pm when di victim car breakdown for busy road, Omotaku plus im gang come demand money from am by force. Lagos Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, post video for X say di […]

todayJanuary 15, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds