Lagos

988 Results / Page 53 of 110

Background

Lagos

Customs Gbab 20 Sacks Of Cannabis Worth ₦157.8M For Lagos Waterway

By: Rilwan Agbomeji Di Western Marine Command Ibafo Lagos don show working again oh, say  dem catch 20 sacks of Cannabis Indica wey worth ₦157.8 million for waterway. According to reports, Customs officers no gree make smugglers waka free, dat dem sabi di hiding place well well. Untop undate doings with tori pipo on Wednesday, Area Controller of Customs, Western Marine Command, Comptroller Patrick Ntadi , sha praise im team […]

todayJanuary 15, 2026 11

Lagos

TCN Call Lagos Govment Make Dem Join Hand Protect Power Infrastructure

By: Rilwan Agbomeji Di Transmission Company of Nigeria don wire call for stronger join bodi doings with Lagos State Govment to protect important power facilities as di city dey expand fast. Di call come from TCN Lagos Regional Transmission Manager, Mojeed Akintola, during a courtesy visit by di company management to Lagos State Planning and Environmental Monitoring Authority. Akintola talk say encroachment for transmission line right-of-way fit cause serious wahala […]

todayJanuary 15, 2026 12 1

Lagos

Lagos Gorment Explain How Hypertension Dey Kpai Lagosians

By: Esther Ayoola Nor be small tin oh, Data from Lagos State Ministry of Health dey show say, about six million residents dey live with hypertension, but most of dem no sabi say dem get di sickness. Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, tuk dis one yesterday for leadership tuk, tuk, wey Lagos State Primary Health Care Board organize with partners like Nigeria Health Watch. Di mata gather top gornment officials, […]

todayJanuary 14, 2026 20 1

Lagos

Lagos Court Odas Meta to Pay Femi Falana $25,000 Say Dem Scarra Im Mental Health

By: Esther Ayoola Lagos High Court for Tafawa Balewa Square don order Meta Platforms Inc. make dem pay Senior lawyer, Femi Falana SAN twenty-five thousand dollars say dem go put hand for im mata without permission. U sabi say, Falana go complain to court, say Meta publish video and voice message wey claim say e get prostate sickness, and say dat one na im private life, and for naija law, […]

todayJanuary 14, 2026 12 1

Lagos

FG Order Night Repair For Lagos–Ota–Abeokuta Road

By: Esther Ayoola Di Federal Government on Tuesday order immediate palliative repair work for Lagos–Ota–Abeokuta Road to fix serious damage and restore free traffic movement. Minister of Works, Dave Umahi, give di directive when e inspect di federal highway wey link Lagos State and Ogun State. Umahi explain say dem assess about 22 kilometres of di road, but repair work go focus on about 18 kilometres wey don bad well-well. […]

todayJanuary 13, 2026 21

Lagos

Lagos Council declare Seven-Day Mourning For Badagry King

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Badagry Local Gornment, Babatunde Hunpe, on Tuesday don go declare, say dem go observe seven days of mourning for di late Akran of Badagry, Aholu Menu Toyi I, wey die on Monday, January 12. Hunpe make dis announcement for Badagry through im Chief Press Secretary, Kriko Augustine. Di govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, approve di announcement as Akran join him ancestors peacefully afta […]

todayJanuary 13, 2026 23 3

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According […]

todayJanuary 13, 2026 13

Lagos

Lagos Court Kramp Man For Yahooing N60m Naira

By: Esther Ayoola Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do. Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing. Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel. […]

todayJanuary 13, 2026 15 4

Lagos

Akran Of Badagry, Oba De Wheno Menu-Toyi, Die For Age 89

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday. Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs. Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry […]

todayJanuary 12, 2026 29 1029

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds