National

1427 Results / Page 24 of 159

Background

National

Yobe Gorment Put Mouth For Military Air Strikes For Borno State

Yobe State Gornment, through im Security Adviser Brig Gen Dahiru Abdulsalam (retd.), don explain wetin hapaun for Borno say di incident involve Boko Haram for Jilli community. Dem also clear say, di strike no happen for Yobe State, but for Gubio Local Government Area inside Borno State. E explain say on Saturday, April 11, 2025, Air Component of Joint Task Force Operation HADIN KAI carry out air strike for Jilli, […]

todayApril 13, 2026 27

National

FG Remove Import Duty For Buses, EVS, Machine To Ease Economy Wahala

Federal Gornment don grant waiver wey go remove import duty for mass transit buses, electric vehicles, and manufacturing machines. Dis move come as President Bola Ahmed Tinubu direct economic team make dem find way reduce pressure wey high fuel price and global crisis dey put on Nigerians. According to statement wey Presidential aide Dada Olusegun post for X, di policy na to hellep reduce inflation and make life and business […]

todayApril 13, 2026 16

National

Tax Reform Team Say Oyedele Nor Make Any Error For Di Reform

Presidential Fiscal Policy and Tax Reforms Committee don deny report wey tuk say Minister of State for Finance Taiwo Oyedele admit say new tax law get error. Dem tuk say, di news misrepresent wetin di minister actually tuk during fireside chat for Nigerian Bar Association Section on Legal Practice conference for Lagos. Dem sti clear say e no tell pipo make dem dey wait for any legislative probe, as certified […]

todayApril 13, 2026 19

National

NAF Launch Probe Over Air Strike Wey Allegedly Hit Borno Market

Nigerian Air Force don start investigation over report say dia air strike wey hapun on April 11, 2026, hit market for Jilli, Borno State, wey cause civilian wujuries. Dem say, dem dey take any report of civilian harm serious, and dem no wan joke with protection of innocent pipo. As part of di mata, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke, don order Civilian Harm Accident and […]

todayApril 13, 2026 14

National

Governor Zulum Tell Borno Residents To Stop Supporting Boko Haram

By: Esther Ayoola Borno State Governor, Babagana Zulum don warn residents make dem no support, hide or supply Boko Haram insurgents anything. Air Component of Joint Task Force (North East), Operation Hadin Kai, carry out operation for Jilli area for Gubio LGA on Saturday. Jilli na border community wey dey between Gubio Local Gornment Area for Borno State and Geidam Local Government Area for Yobe State. For statement wey di […]

todayApril 13, 2026 16

National

INEC Clear Air, Deny Report Wey Say Amupitan Dey Support APC

Independent National Electoral Commission don deny report say, dem nor copy post any press statement from a Special Assistant to President Bola Tinubu on New Media, Dada Olusegun, describing di report fake and misleading. According to statement wey INEC secretary, Adedayo Oketola sign, di mata dat INEC Chairmo, Joash Amupitan, repost All progressive congress post for X na fake rumour. Say di allegation post wey go viral for X say […]

todayApril 13, 2026 16

National

Presido Tinubu Salute Senior Man Aliko Dangote As Im Clock Plus One

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don send congratulation to Nigerian billionaire Aliko Dangote as im add plus one to im age, hailing di seniorman role for Naija and Africa economic growth. For statement wey Special Adviser Bayo Onanuga release on Friday, Tinubu tuk say Dangote entrepreneurial vision, resilience and innovation don change key industries for di country. Tinubu highlight how Dangote big projects like refinery, petrochemical plants […]

todayApril 10, 2026 27

National

World Bank Report Say Naija Poverty Now Na 63%

By: Esther Ayoola World Bank don share update, say poverty dey press Naija for neck, dat e don rise enter 63% for 2025, not minding say inflation slow down small. Dem show for dia Naija Development Update say, poverty move from 56% for 2023, enter 61% for 2024, then reach 63% for 2025. Dis one mean say economic stabilizing nor be for di poor for Nigerians. In all, about 140 […]

todayApril 10, 2026 20

National

TUC Beg FG Make Dem Use Crude Money Help Refineries

By: Esther Ayoola Trade Union Congress of Naija don tell Federal Gornment say make dem use excess crude oil money support local refineries, so dat dem go sell fuel cheap for Nigerians. TUC President, Festus Osifo, tuk dis one for Abuja, say like dis now say, petrol fit reach N2,000 per litre, if gornment no act fast. Festus sti press tuk on why wi federal gorment need act fast, saying […]

todayApril 10, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds