National

1294 Results / Page 63 of 144

Background

National

President Tinubu Wire Call To West African Leaders To Join Bodi Fight Terrorism

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don  recharge 100 naira,  wire wire call  to West African leaders say make dem join hand fight terrorism and military takeovers for di region. As im dey vex, i nor fit tuk so, im carry the phone give im  vice, Kashim Shettima for di 68th ECOWAS summit wey sup for Abuja on Sunday. Tinubu yarn say no single country fit bring stability alone, and […]

todayDecember 15, 2025 12

National

FG Rake Full Newspaper Say Health Sector Standard For Di Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola Wi Federal Gorment don bring mata dey rake full newspaper say Nigeria health sector dey stable for di last two and half years, and nothing serious don disturb am. Minister of Health, Ali Pate, yan this one on Sunday for TV sit down tuk, say na because di federal gorment give am beta attention and dem put money for di sector. Pate talk say, “For di last […]

todayDecember 15, 2025 9

National

PDP Back Governor Diri Say Make Dem Do Autopsy Test For Im Late Deputy

By: Esther Ayoola Bayelsa PDP don support Governor Douye Diri decision to carry out autopsy on him late deputy, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, make dem sabi how im die. Governor Diri give the order on Saturday when former President Goodluck Jonathan come condole with am and Ewhrudjakpo family for Government House, Yenagoa. Diri talk say dem do am because social media dey spread fake rumor and talk about wetin kpai the […]

todayDecember 15, 2025 17

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey […]

todayDecember 12, 2025 18

National

Dangote Reduce Fuel Price Again To N699

By: Rilwan Agbomeji E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian. Di latest reduction sharply drop (gboza for ground),  afta Chairmo, Aliko Dangote  do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on  friday, and dat, di reduction go continue go […]

todayDecember 12, 2025 19

National

APC Officially Arrange Office For Fubara As New Member

By: Rilwan Agbomeji Di All Progressives Congress for Rivers State branch, don officially set table for oga Govo Siminalayi Fubara as di newest member wey Kawasaki from di PDP to APC. Like dis like dis , di state APC Chairmo Tony Okocha carry di mata for head like say na government work dey share share di govo left, right and center on top social media , dis one happen for […]

todayDecember 12, 2025 28

National

Maryam Sanda Death Ruling Stay As E Be

By: Rilwan Agbomeji Supreme Court no change mouth, dem uphold di death sentence wey Maryam Sanda collect. Di court, for a 4–1 decision, confirm say nothing dey to change di original judgment. All di grounds wey she take appeal, dem cancel am and call di case empty. Justice Moore Adumein, for di lead verdict, confirm say prosecution show enough evidence to nail di matter.

todayDecember 12, 2025 20

National

Senate Clear Fani-Kayode, Omokri, Ikpeazu, Ex-INEC Chair, Others For Ambassadorial Posts

By: Rilwan Agbomeji Di Senate Committee on Foreign Affairs turn to small theatre as dem screen Fani-Kayode, Dambazau, ex-INEC oga Yakubu Mahmood, Florence Ajimobi, Reno Omokri and di rest for ambassadorial positions. As senior men waka enter di meeting, all di ambassador wey dem wan screen take di bow but Omokri batch reach na so everywhere catch fire between Senator Mohammed Ali Ndume and Senator Adams Oshiomhole.

todayDecember 12, 2025 36

National

FG Recuit 94,000 New Security Officers To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Nor be small gbege say, boys dey hide for area as wi Federal Gorment 94,000 bring plan to recruit new security to battle insecurity. For inside statement on Thursday by di Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, dey confamate dis tory. Police Service Commission and Nigeria Police Force no even help mata at all, as dem declare say na about 50,000 new constables dem want […]

todayDecember 12, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds