National

1294 Results / Page 65 of 144

Background

National

Tinubu Open Plan Say Im Wan Use Sea Resources Take Create Jobs

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don drop mata again say contri pipo go join bodi use sea and mami water resources take boost economy, create work, and bring long-term progress. Vice presido Kashim Shettima talk di matt for presidential villa during meeting with senior executive course 47 from national institute for policy and strategic studies. Tinubu direct all ministries and agencies make dem check NIPSS report […]

todayDecember 11, 2025 12 1

National

President Tinubu Ginger Area Say Make Forest Guards Dey Carry Gun

By: Rilwan Agbomeji To deal with all di jaguda bois for inside di obodo Naija, wi oga Presido Bola Tinubu don vex oh, approve forest bodi guards across Naija say dem dey carry kalachi as part of new plan to fight banditry, kidnapping and illegal mining for rural areas. Di announcement come afta Federal Executive Council meeting for Abuja on Wednesday, where Tinubu talk say security matter don reach level […]

todayDecember 11, 2025 20 1

National

Senate Argue About Di Removal Of Police Escort

By: Rilwan Agbomeji Na beta agument shelle for di Nigeria senate on Wednesday,  say  Senator Abdul Ningi cry out as dem collect im escort afta Presido Tinubu order make dem withdraw police from VIPs, while many ministers, big men and entertainers still dey move with police. Ningi ask why di directive no dey affect everybody and say National Assembly no suppose be di only pipo to suffer change. As di […]

todayDecember 10, 2025 12 1

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Rilwan Agbomeji Di Pipos Democratic Parti  National Chairmo,  Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be one house, and dat 29 state chairmen tanda gallant dey await confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja on Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. […]

todayDecember 10, 2025 11

National

Drama As Senate Presido, Akpabio Wish Natasha Akpoti Hapi Birthday

By: Rilwan Agbomeji Small drama happen for senate on Tuesday, e shock  every bodi like konfam shock shock say  Senate President Godswill Akpabio dey celebrate im 63rd birthday con still wish senoir woman Senator Natasha Akpoti-Uduaghan. Say im birthday, na di birthday of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey represent Kogi-central, wey dey 47. As e dey normal for Senate, Akpabio call all di lawmakers wey dey celebrate am to specially recognise […]

todayDecember 10, 2025 18

National

President Tinubu Repeat Im Order Say Make Police Officers Return To Normal Policing

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu don repeat talk again, say make police officers nor guard VIPs again and make dem return back to normal police work. E talk dis one just before e begin federal executive council meeting for state house, Abuja on Wednesday. From aproko wey reach konfam news table say, Tinubu don direct minister of interior make e work with IGP and NSCDC make dem […]

todayDecember 10, 2025 26 1

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Esther Ayoola The Pipos Democratic Parti  national chairmo, Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be  one house,  and dat 29 state chairmen tanda  gallant dey await  confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. he […]

todayDecember 10, 2025 13

National

Vice Presido Shettima Clear Tinubu Security Doings

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido Kashim Shettima don align marras say, president Bola Tinubu nor dey security matter play at all at all. Oga vice dey yan dis one for inside  NISS 18th executive intelligence management course crew for him office for abuja. Say, na about 78 guys including  commandant joseph odama, ni come  drop their final course report for VP. Shettima carry the report, yan say government dey […]

todayDecember 10, 2025 19 1

National

Senate Raise Alarm Say WAEC Wan Stress SS3 Students

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for  di Nigerian Senate, say Naija education  dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of  curriculum and  dat, SS3 students wey  go register for the exam go  write subjects wey dem never even see. Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis  […]

todayDecember 10, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds