OBODO NAIJA

770 Results / Page 12 of 86

Background

OBODO NAIJA

Education Minister Hail NYSC, Say Tech Dey Fight Fraud

By:  Damilola Adekunle Education Minister, Dr Tunji Alausa, don hail NYSC as dem use technology fight fraud and make registration and deployment of corp members sharp. Alausa tok dis on Wednesday for Abuja when NYSC Director-General, Brigadier General Olakunle Nafiu,visit am for office, tok say di scheme don record serious transformation since e embrace digital technology. Di minister tok say although some pipo first resist di move, di Digital change […]

todaySeptember 9, 2026 15

OBODO NAIJA

Alcohol Dey Encourage Banditry, E Dey Destroy Brain And Kidney

By: Damilola Adekunle NAFDAC DG, Professor Mojisola Adeyeye, don warn pipo say alcohol fit damage important organs for pesin bodi. She tok say na because sachet and small PET bottle alcohol don become too common, NAFDAC ban alcohol wey dey below 200 millilitres. Adeyeye tok say even as some pipo  no dey  happy as dem ban am, Nigerians still dey worry about how alcohol fit affect di  future of dia […]

todaySeptember 9, 2026 12

OBODO NAIJA

Keyamo Tell Everybody Make Dem Condemn Attack On Peter Obi

By: Adekunle Damilola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don call for fairness and consistency for how media dey report political matters. Keyamo make di call while condemning di disruption of NDC presidential candidate Peter Obi  planned visit to Benue State. Im say whether na internal disagreement for NDC or supporters of APC and other rival parties cause di incident, nobody suppose tolerate am for democracy. Keyamo say […]

todaySeptember 9, 2026 13

OBODO NAIJA

Peter Obi Carry Perper Body Ginger Give Federal Gornment

By: Mariam Ajayi Peter Obi don call on federal gornment to save thousands of Nigerians wey terrorists don drive comot dia villages. Obi drop dis fire call for X after e storm Mangu IDP camp inside Plateau State, an u know di badness wey sup for  Yelwata inside Benue State on Tuesday, wey boy block am. Supporters con dey ask, wetin dey give dis man mind, di former Anmabra state […]

todaySeptember 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Nigerians for UK Vex Over Manchester Passport Delay

By: Ayobami Dada Nigerians wey go collect passport for Manchester, UK, don vex as dem wait for hours without anybody attending to dem on Tuesday. One Nigerian, Oluomo of Derby, tok say people wey reach di centre since 9 a.m. still dey wait by 11:30 a.m., even after dem travel far and comot work. Oluomo say di whole thing no make sense, and e call for better arrangement so Nigerians […]

todaySeptember 8, 2026 11

OBODO NAIJA

Makinde Fire Back at 2027 Doubters, Say Nigerians Go Decide

By: Ayobami Dada APM presidential candidate Seyi Makinde on Monday for Abuja say nobody fit write off millions of Nigerians wey go vote for 2027 election, as he launch “Reset Nigeria” campaign. Makinde say im no dey support return to fuel subsidy, but want Nigerians to benefit more from di crude oil wey Nigeria produce through cheaper supply to local refineries.

todaySeptember 8, 2026 20

OBODO NAIJA

NAFDAC Boss Blame “Wetin I Fit Gain?” Mentality for Naija Wahala

By: Ayobami Dada NAFDAC DG Mojisola Adeyeye on Monday say some Nigerians no dey like to serve dia country, as she respond to calls for her removal during engagement with journalists. Adeyeye say she spend 34 years for America, including 30 years as professor, before she retire and return Nigeria to lead NAFDAC because she want serve di country.  

todaySeptember 8, 2026 12

OBODO NAIJA

Obi Hail Seyi Makinde Say E Get Doings To Be President

By: Yusuf Abuh Political shocky shocky naim hapun for Abuja on Monday, dis NDC presidential candidate, Peter Obi, whether messi, abi Maradona confusion gadinma, unto say nobody dey see di next move coming. On Monday na so di presidential candiate enter di inauguration of Allied Peoples Movement, APM presidential candidate, Seyi Makinde, campaign office, say di Oyo state qualify to be presido. Na so everybody shout Shuuuiiii, what do mean, […]

todaySeptember 8, 2026 11

OBODO NAIJA

Dangote Say Drivers, Cooks Fit Buy Shares for Refinery

By: Mariam Ajayi Aliko Dangote tuk say drivers, cooks, traders and other ordinary Nigerians go get chance buy shares for Dangote Refinery through di proposed IPO. E say di offer wey get 4.1 billion shares at N525 each fit raise over N2 trillion and help ordinary people own part of di 700,000-barrel-per-day refinery. Dangote add say investors fit also enjoy dollar-denominated dividends, wey fit help dem handle expenses outside Naija.

todaySeptember 7, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds