OBODO NAIJA

770 Results / Page 10 of 86

Background

OBODO NAIJA

Police Rescue Two Kidnap Victims,Kpai Three for Niger

By: Mariam Ajayi Niger State Police don rescue two pipo wey kidnappers gbab from Wako village, New Bussa, after security team clash with di gunmen for Wawa forest on September 10. Police PPRO, SP Wasiu Abiodun, say surveillance team and vigilantes intercept di kidnappers after dem demand ransom for di two victims. Di gun battle leave three suspected kidnappers dead, while di two victims escape unhurt and other gang members […]

todaySeptember 15, 2026 21

OBODO NAIJA

NNPC Target Over 600 Trillion Cubic Feet Gas Reserve

By: Mariam Ajayi NNPCL don tok say e wan turn Naija to major gas hub for di world, using plenty gas take boost industry and export. NNPC Executive Vice President for Gas, Power and New Energy, Olalekan Ogunleye, tok dis one yesterday, Monday, September 14, 2026, for di 2026 Gas Technology and Exhibition Conference, GASTECH, for Bangkok, Thailand. Ogunleye say Nigeria get over 215 trillion cubic feet of proven gas […]

todaySeptember 15, 2026 14

OBODO NAIJA

Northern Igbo, Women Ulama Back Tinubu 2027

By: Mariam Ajayi Bola Tinubu second-term project don gather heavy momentum as two strong forces from North jump enter motor-park to register full loyalty for e 2027 re-election bid Di Igbo Political Movement across di 19 northern states plus Abuja swear heavy oath say dem go mobilize no less than two million solid voters to drop ballots give Tinubu and all e APC boys And also Kaduna State Governor Uba […]

todaySeptember 15, 2026 16

OBODO NAIJA

Remi Tinubu Beg Country Man Save Pregnant Women, Pikins

By: Mariam Ajayi Senator Oluremi Tinubu don raise alarm as pregnant women and pikins dey die anyhow for obodo Naija, calling on leaders and billionaires to help save lives. First Lady fire dis rifle  Federal Gornment unload 215,000 pakages for  pregnant womens, dat is, 40,000 mama food-support packs, plus 40,000 sets of newborn pikin clothes to share give poor mothers for every corner of obodo Nigeria. Mama Remi clear di […]

todaySeptember 15, 2026 17

OBODO NAIJA

Dangote Say Make Una Thank Naija for Keeping Planes Fly

By: Ayobami Dada Dangote Group oga, Aliko Dangote, don tell Europe say make dem thank Naija under Presido Bola Tinubu, as Dangote Refinery don become di biggest supplier of jet fuel to Europe since August 2026. Dangote tok am on Monday when di refinery IPO start for Nigerian Exchange, NGX, saying dem don sell all dia jet fuel for August and September because Europe demand high. E say refinery don […]

todaySeptember 14, 2026 11

OBODO NAIJA

Iyana-Ipaja/Iyana-Iba Drivers Strike Over Extortion

By: Ayobami Dada Commuters for Iyana-Ipaja/Iyana-Iba axis don dey stranded as commercial bus drivers stop work to protest alleged extortion. Di drivers accuse LASTMA, Police, FRSC and NURTW members of demanding money from dem regularly. Dem also say LASTMA dey impound dia vehicles over traffic offences, causing serious financial losses.

todaySeptember 14, 2026 12

OBODO NAIJA

Police Arrest 28-Year-Old Suspected Drug Dealer For Ibadan

By: Ayobami Dada Police don arrest 28-year-old Rilwan M for Ibadan after dem act on intelligence about suspected drug activities. Police say dem recover suspected Indian hemp, methamphetamine and other dangerous drugs from am. Dem say investigation still dey go on to find other people connected to di drug trade. Police say dem go charge di suspect to court after dem complete di investigation.

todaySeptember 14, 2026 12

OBODO NAIJA

NDC Condemn Attack On Members For Enugu

By: Mariam Ajayi NDC leadership don condemn alleged attack on im members during grassroots meeting for Obuoffia Ward, Nkanu West Local Government Area of Enugu State. Di party accuse suspected state-sponsored thugs of attacking im members and warn say di alleged assaults must stop. NDC also accuse security agencies of not doing enough to respond to attacks on opposition groups for Enugu and other parts of South-East, while recalling similar […]

todaySeptember 14, 2026 11

OBODO NAIJA

Petrol Price Rise Again As Crude Oil Pass $100 Per Barrel

By: Mariam Ajayi Petrol price don rise for different filling stations across Nigeria as crude oil price don pass $100 per barrel. MRS don increase im petrol price for Lagos and environs from N1,300 to N1,400 per litre, while NNPC filling stations don move from N1,275 to N1,375 per litre. Some independent marketers don also increase dia price to N1,400 from around N1,360, following Dangote Refinery increase in petrol gantry […]

todaySeptember 14, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds