OBODO NAIJA

770 Results / Page 11 of 86

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Tell World Bank, UN Say Make Dem Change

By: Mariam Ajayi Tinubu don tell world leaders for India say make dem rearrange UN and world finance bodies. Senior man presido porporly dis mata through hin,  Vice, Kashim Shettima, inside di 2026 BRICS Summit for New Delhi. According to Tinubu, table gat turn, cause current doing nor dey really dey show economic and population of poor countries, make dem nor go think say Nigeria and other third world countries […]

todaySeptember 14, 2026 8

OBODO NAIJA

Police Burst Fake 50,000 Recruits Training Story

By: Mariam Ajayi Police don expose fake statement wey dey waka round social media, say IGP Olatunji Disu don order training for 50,000 new police recruits. Police tuk say dem no issue or approve di statement, even as dem use Police letterhead and name of dia spokesperson package am. Di fake paper claim say Police don arrange training for di new recruits, with focus on discipline, professionalism and human rights. […]

todaySeptember 11, 2026 15

OBODO NAIJA

Shettima Land India To Represent Tinubu For BRICS

By: Damilola Adekunle Vice Presido Kashim Shettima don land New Delhi, India, to represent Presido  Bola Tinubu for di 18th BRICS Leaders’ Summit. Shettima dey lead high-level Najia team as Najia dey look to boost trade, investment and International relations with BRICS member and partner countries. Najia time  go also push areas like agriculture, technology, AI, industrial development and digital economy. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu say Najia wan learn […]

todaySeptember 11, 2026 14

OBODO NAIJA

Akpata Say AI No Fit Replace Courtroom Argument

By: Damilola Adekunle Olumide Akpata tok  say pipo wey wan succeed for law must sabi build strong argument and convince pipo, as AI no fit replace human courtroom skills. Akpata, wey be di 30th President of NBA, tok dis for Port Harcourt for di NDDC 2026 Moot and Mock Trial Competition for law students across Niger Delta universities. E commend NDDC for di competition and tell universities to establish moot […]

todaySeptember 11, 2026 13

OBODO NAIJA

Federal Gornment Wan Comot Attempt Suicide From Criminal Mata

By: Mariam Ajayi Federal Government wan start to comot criminal mata  for attempt suicide, as Federal Executive Council approve Health Ministry position on di matter. Minister of State for Health, Dr Iziaq Salako, tuk dis for Abuja during 2026 World Suicide Prevention Day commemoration. E say di proposal go now move go National Assembly for lawmakers to begin necessary legislative process. Salako argue say pipo wey dey face mental health crisis […]

todaySeptember 11, 2026 14

OBODO NAIJA

NDC Declare Say 2027 Election Go Be Smooth Ride

By: Mariam Ajayi Di Naija democratic congress, human Activist, Aisha Yesufu don rake full newspaper say 2027 election omormor doings  for  Peter Obi, dat e go easy di NDC to win compare to 2023. Di senior woman fry dis mata for TV sit down tuk, as she chest different question about di elections. U sabi say for di last election,  Obi use Labour Party pack 6.1 million votes come third […]

todaySeptember 11, 2026 14

OBODO NAIJA

IGP Disu Beg Nigerians Make Dem Stop Recording Police

Di Inspector-General of Police, IGP Tunji Disu, don warn Nigerians make dem stop to record police officers while dem dey work and turning dem to skit content, saying e dey discourage officers. Disu talk dis for press conference for Abuja, saying police officers need full concentration to do dia work, even as e acknowledge say Nigerians get constitutional right to record officers wey dey perform public duties for public places. […]

todaySeptember 10, 2026 11

OBODO NAIJA

Peter Obi Talk Say E No Need 100 Years To Fix Nigeria

NDC presidential candidate, Peter Obi, don talk say e no need 100 years to put Nigeria back on di right track, as e insist say di country dey go wrong direction now. Obi, wey promise say e go spend only one term as Nigeria Presido, talk dis on Thursday during interview with one tuk tuk station, saying e no desperate to become presido. E say once e enter office, e […]

todaySeptember 10, 2026 13

OBODO NAIJA

Federal Gornment Release Allowance For Lecturers

By: Mariam Ajayi Federal Gornment don release  CATA for lecturers across federal universities, polytechnics and colleges of education, covering January to August 2026. Education Minister, Dr Tunji Alausa, announce dis on Wednesday for Abuja after e inaugurate di Ministerial Committee on Accreditation, saying di payment follow di 2025 agreement between FG and ASUU. Di allowance dey help academic workers buy tools and materials wey dem need for teaching, research and […]

todaySeptember 9, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds