OBODO NAIJA

770 Results / Page 22 of 86

Background

OBODO NAIJA

FG Say Petrol Subsidy Removal Generate N15.8tn

By : Jolayemi Olajide Federal Government yarn on top the removal of petrol subsidy and unification of foreign exchange market don generate additional N15.8 trillion for Federation between June 2023 and December 2025. Minister of Finance Taiwo Oyedele disclose dis on Wednesday for media briefing on government reform scorecard, saying states and local governments get di bigger share of di money. Oyedele explain say di subsidy savings no dey appear […]

todayAugust 19, 2026 21

OBODO NAIJA

Davido Hail Adeleke Re-election, Say Other Govos Fit Learn From Am

By: Kofoworola Olayinka Afrobeat singer Davido on Tuesday hail him uncle, Osun State Gofnor Ademola Adeleke, after e win di gofnorship election for second term, saying di victory na victory for di pipo. Davido talk dis one for press conference for Osun, where e say Adeleke work and performance suppose serve as example to other gofnor and public officials. Di singer also praise Osun voter for standing firm and protecting […]

todayAugust 19, 2026 18

OBODO NAIJA

Dele Momodu Say Tinubu Fail Beta Style For Osun Election

ADC chieftain, Dele Momodu, don describe Gorfnor Ademola Adeleke victory for di Osun gorfnorship election as sabi man doings say oga Presido Bola Tinubu, and di All Progressives Congress, APC nor get level. Im fry dis mata for TV sit down tuk on Monday, Momodu say di result suppose make APC guige dia guard, if not dem go cry. Momodu, wey support Adeleke before di election, talk say di contest […]

todayAugust 18, 2026 14

OBODO NAIJA

Over 200 KASU Lecturers Stop Work, Tok Say Strike Fit Start

Nor be small gbege for Kaduna state university, say Over 200 professors and other academic workers don comot from Kaduna State University, KASU, over poor working conditions and di university failure to implement di 2025 Federal Government-ASUU agreement. ASUU-KASU chairmo, Abubakar Abdullahi, fry dis mata on Monday for press conference for di union secretariat inside Kaduna State University. Abdullahi say di 2025 FGN-ASUU agreement, wey suppose improve working conditions for […]

todayAugust 17, 2026 21

OBODO NAIJA

Edo Assembly Speaker Comot From House of Assembly

Edo State House of Assembly Speaker, Blessing Agbebaku, don resign on Monday as some lawmakers dey move to impeach am, and im media aide, Ivy Ebojele, konfamate say he don comot. After di resignation during Monday plenary for Edo Assembly, Yekini Idiaye, wey represent Akoko-Edo Constituency 1, don emerge as di new Speaker. Idiaye tell journalists after di sitting say Agbebaku leave office because of poor leadership and alleged corruption, […]

todayAugust 17, 2026 16

OBODO NAIJA

Must Read: Di Truth About Marriage Wey Most Pipo No Understand

Marriage no be just about two pipo wey dey live under one roof. E dey involve trust, communication, friendship, sacrifice, patience and di ability to respect and protect each other, even when things hard. But wetin go happen when di trust disappear? Wetin go happen when suspicion replace communication, quarrel replace affection, and di pipo wey promise to protect each other begin to hurt each other?   Read dis story […]

todayAugust 15, 2026 76 10

OBODO NAIJA

President Tinubu Rake Say Fuel Subsidy Removal Dey Show Workings

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don rake again say removal of fuel subsidy dey benefit ordinary Nigerians, dat very soon im soon share di report card. Senior man presido fry dis mata as im receive Naija oil workers oganization, NUPENG leaders for Presidential Villa. Baba Seyi say, im nor understand why bad belle pipo dey drag about subsidy, say na di subidy money dem take dey package […]

todayAugust 14, 2026 15

OBODO NAIJA

Edo Police Dey Investigate Officers Over Alleged ₦1m Extortion

By: Olabisi Olatunji Edo Police don order investigation after officers for Okpella Division allegedly arrest young men, accuse dem of cultism and collect ₦1 million to free dem. Di allegation come after di young men post video online, accusing di officers of collecting di money. Police Commissioner, CP Patrick Daaor, don summon di accused officers for questioning. Police also invite di alleged victims make dem tell investigators dia own side.

todayAugust 13, 2026 17

OBODO NAIJA

FG Warn Nigerians Make Dem Stop Steal Road Materials

By: Olabisi Olatunji Federal Gornment don warn Nigerians make dem stop vandalising and carrying construction materials from Lagos-Calabar Coastal Highway. FG media aide, Francis Nwaze, give di warning on Thursday, August 13, 2026, after pictures show some people allegedly dey carry materials from di road project. Nwaze say anybody wey dey vandalise di highway dey attack national property and money wey belong to Nigerians. Di warning come few days after […]

todayAugust 13, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds