OBODO NAIJA

770 Results / Page 39 of 86

Background

Lagos

Lagos Gornment kramp Man Wey Dump Dirty for Drainage

BY Esther Daniel Lagos State Gornment don arrest one 56-year-old man, John Ehidreme, say im allegedly go thruway dirty for gutter for No. 18 Oluoga, Ikorodu. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say officials catch the man on Tuesday as government dey step up enforcement of environmental sanitation laws. The arrest come after one video spread online wey show one security guard dey pour refuse from dustbin […]

todayJuly 15, 2026 34 1

OBODO NAIJA

Atiku tuk say make dey check Gbajabiamila Over Corruption Allegation

BY Esther Daniel ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don call for independent investigation into corruption allegation wey dey against President Bola Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila. Atiku say nobody suppose dey above the law and make government investigate the matter properly to allow Gbajabiamila defend himself. E add say gornment no fit claim say e dey fight corruption if top officials no dey held accountable too.

todayJuly 15, 2026 19

National

INEC Beg Federal Government Make Dem Increase Money Before 2027 Election

By Esther Daniel Oga Chairmo for wi number one election body, INEC, Prof. Joash Amupitan, SAN, don don bring neck comot say make federal gorment increase dia money for 2027 election. Prof. Amupitan tuk dis one during one courtesy visit to Chairmo  of  wi gorment house pipo wey dey hand money, Dr. Mohammed Bello Shehu, for Abuja. Im say di visit na to strengthen beta working relationship between the two […]

todayJuly 15, 2026 30 3

OBODO NAIJA

INEC Back David Mark ADC Leadership, Reject Rival Group for 2027

By : Jolayemi Olajide Independent National Electoral Commission, INEC, don fry mouth clear di air say na only African Democratic Congress, ADC, leadership wey Senator David Mark dey lead dem go recognise to submit candidates for 2027 general election across Nigeria. INEC National Commissioner, Mohammed Haruna, naim go tuk for interview dat dem don give Mark-led leadership access to the nomination portal. Haruna explain say rival faction no get legal […]

todayJuly 15, 2026 21

OBODO NAIJA

Remi Tinubu, Wike Vow To Finish work for Abuja

By : Jolayemi Olajide Nigeria First Lady, Remi Tinubu, and FCT Minister, Nyesom Wike, don promise say dem go press more development for  abuja resident throat. Dem yarn dis one during project commissioning for satellite town, abuja, say government go build beta roads, and  improve public facilities. According to dem, di plan na to make life easier for residents and open more opportunities for businesses to grow.

todayJuly 15, 2026 20

OBODO NAIJA

Court Order Make Police Arrest Self-Claimed PFIPC Oga Adeyemi

By : Jolayemi Olajide Justice Muhammed Umar of Federal High Court for Abuja don order make police arrest Adeniyi Adeyemi after e no show for court to answer the charges against am. Adeyemi, wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, suppose take plea for eight-count charge wey involve forgery, fraud and impersonation. Even though one lawyer, Genesis Francis, appear for am, the defendant no come court […]

todayJuly 14, 2026 12

OBODO NAIJA

Adeyemi Beg Tinubu Make Independent Panel Touchlight PFIPC Agency Wahala

By: Yusuf Abuh Adeniyi Adeyemi wey dey claim say na im be Director-General of di Presidential Foreign Investment Promotion Council (PFIPC), don beg wi Presido, Bola Tinubu, say make im set  make im set up independent panel to investigate di controversy wey surround di council. Adeyemi tok dis one for open letter wey e send give di president, saying di panel suppose dey neutral and include different stakeholders. According to […]

todayJuly 14, 2026 10

OBODO NAIJA

Tinubu Hail Buhari, Say Im Legacy No Go Die

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don konfam again say di life and legacy of former Presido, Muhammadu Buhari still dey inspire Nigerians because of im service, integrity and love for di country. Vice-Presido Kashim Shettima naim use im mouth tok dis one on Monday during prayer session for Abuja to mark one year since Buhari kpai. Tinubu describe Bubu as true patriot wey leave strong mark for […]

todayJuly 14, 2026 21

OBODO NAIJA

Makinde Call Mehn to Touch Light Oriire Kidnap

By: Yusuf Abuh Oyo State Govo, Seyi Makinde, don call for independent investigation into di abduction of children and teachers wey hapun for Ahoro-Esinle and Yawota communities for Oriire Local Gornment on May. Di govo tok dis one for statewide broadcast on Monday for Ibadan after dem hand over 46 children and teachers wey security operatives rescue from bandits. Makinde say international human rights and accountability bodies, including agencies under […]

todayJuly 14, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds