OBODO NAIJA

770 Results / Page 44 of 86

Background

OBODO NAIJA

Wike Camp, Turaki Camp Wait as Court Shift PDP CaseĀ 

By Oluwatosin Ibrahim Federal high court judge, Justice Salim Ibrahim don shift judgment for di PDP leadership mata to July 10 to decide who be di authentic leaders of di party between Nyesom Wike camp and di interim National Working Committee wey Tanimu Turaki lead. Di court also move hearing for appeal wey ADC, Accord and three oda political parties file against dia deregistration go July 14. Senator Adolphus Wabara […]

todayJuly 8, 2026 19 2

OBODO NAIJA

President Tinubu Pick Squad To Create Laws For State Police Ā 

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don launch ogbonge special quadĀ  wey dem dey call Presidential Working Group on di National Policing Bill, to map di way for Naija state police Na Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, stand in for di Presido to open di committee group for inside di Presidential Villa for Abuja. Dis move dey happen after di National Assembly pass di new law […]

todayJuly 8, 2026 18

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Give ICPC 30 Days To Investigate Fake PFIPC

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don order Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission, wey dem dey call ICPC, say make dem touch light every as e take concernĀ  Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC) and di ogbonge agency wey don dey cause jogolo for weeks now. Presido say make ICPC finish di investigation and submit full report give am within 30 days. According to Special […]

todayJuly 8, 2026 29 1

OBODO NAIJA

FG Wan Bring back more Nigerians Back from South Africa Over Xenophobic AttackĀ 

By : Jolayemi Olajide Nigeria Government say e go sti bring Nigerians back from South Africa on Tuesday because of fresh attacks on foreigners. Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu tell news tatafos on Tuesday, say another flight go leave dis week. Three groups of Nigerians don already return since the evacuation start last month. She also advise Nigerians wey still dey South Africa make dem think well whether to stay […]

todayJuly 7, 2026 17

OBODO NAIJA

Information Minister, Idris Position North News Tatafos For Beta Tomorrow

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, don clear, clear Nigerian tatafos for North,Ā  not to burn di country with bad news report. Im tuk dis on for di first Arewa Media Summit wey shelle for Kano on Monday. Di Minister explain say di future of di region no depend only on better roads or farming, and dat tori dem wey dis tatafos dey put out sti, fit […]

todayJuly 7, 2026 21

OBODO NAIJA

Tinubu Send FCCPC To Checkmate Big Tech

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don order wi Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) dat make dem touchlight all di big technology companies and AI to ensure say dem nor spoil business for Nigerians. Di order dey come after the Nigerian Press Organisation (NPO), number one joinbodi tatafos, wire message to wi baba seyi say tech companies wan comot food for dia table. According to statement […]

todayJuly 7, 2026 15

OBODO NAIJA

Reps Approve Customs N11.07trn Revenue Target for 2026

By: Yusuf Abuh Di House of Representatives Committee on Customs don carry hand up approve di2026 budget for Nigeria Customs Service, with target to make 11.07 trillion naira revenue. Customs Boss, Adewale Adeniyi, tell di lawmakers say di target make brain because dem beat dia 2025 target when dem clear 7.25 trillion naira. For di new budget, Customs allocate big money for capital projects, staff overhead, and dem even plan […]

todayJuly 6, 2026 18

OBODO NAIJA

IPMAN Promise Cheaper Fuel For Nigerians

By: Yusuf Abuh Senior man presido of petro sellers for di obodo Nigeria,Ā  (IPMAN), Elijah Shettima, don drop micro soft word sayĀ  Nigerians nor need to worry body too much, dat petrol price go soon come down. Shettima tok dis one for interview wey e get with news tatafos for Abuja on Monday. E say IPMAN main plan na to make independent marketers fit buy petrol directly from Dangote Refinery. […]

todayJuly 6, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds