OBODO NAIJA

770 Results / Page 45 of 86

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Beg Rotary Make Dem Join Hands Build Nigeria

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don wire call to naija obodo oyinbo business partners (Rotary International) say make dem flog business come, whether, healthcare, education, youth empowerment and community development across, say Nigeria go do thank you sir. Oga presido, tuk dis tuk through im Seco to di gorment of federation, George Akume wia dem go sing congratulation song for Olayinka Babalola for becoming di second African […]

todayJuly 6, 2026 17

OBODO NAIJA

Army Chief To Employ AI

By: Yusuf Abuh Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, don call on Nigeria say time don reach for us to use artificial intelligence (AI) and other new technology take fight di insecurity gbeges  for di country. E tok dis one during Nigerian Army Day Celebration lecture for Port Harcourt, say insecurity don pass terrorism and banditry enter cyber attacks, organised crime and other tech-driven threats. Shaibu say di […]

todayJuly 6, 2026 20

OBODO NAIJA

Reps Beg Tinubu To Hold On NYSC Reform

By: Yusuf Abuh One house of Rep member from Benue, Philip Agbese don beg wi oga Presido, Bola Tinubu, make im match break for  di proposed NYSC reform until beta eyes look di mata wella. Di lawmaker wey be number 2 tuk-tuk person, yan dis one on Sunday, say even though dem need to modernise di scheme, e no suppose spoil di main aim wey be to unite Nigerians. U […]

todayJuly 6, 2026 20

OBODO NAIJA

Court Back David Mark As ADC Leader

Di Federal High Court for Abuja don back David Mark branch as di correct leader of di  opposition party, African Democratic Congress (ADC). Justice Musa Liman throway di case wey one House of Reps member, Leke Abejide, file, according to di court senior man, dem nor get power to put mouth for political party inside house wahala. Former Vice-President Atiku Abubakar don  hail dis judgment,  say di ruling na big […]

todayJuly 3, 2026 22

OBODO NAIJA

President Tinubu Open New ECOWAS Building For Abuja

Wi oga Presido, Bola Tinubu don open mouth whaa for ground, tell di world say Nigeria and peace mata na five and six. Baba seyi tuk dis one through im vice, Kashim Shettima as dem ma go open di new ECOWAS headquarters for Abuja, Senior man presido fry mouth dat make di rest of Africa bring deal come and dat Nigeria active 2.4.7, nor be small.

todayJuly 3, 2026 34 3

OBODO NAIJA

Tinubu Say Nigeria Economy Dey Work

Wi oga Presido, Bola Tinubu don again, stand tall like nepa pool again, knack chest, say, di economic reforms wey im gornment bring out, dey show beta workings for di obodo Nigeria. Di Presido drop dis word on Thursday during di very first State House Media Dinner wey shelle for Abuja. Tinubu accept say true-true di mata hard small, like labour pain, but dat di economy don dey steady now […]

todayJuly 3, 2026 18 3

OBODO NAIJA

Kelechi Anosike Blast Govo Alex Otti

Govonorship candidate for Peoples Democratic Party (PDP) for Abia 2027 guber race, Kelechi Anosike, don blast  Governor Alex Otti administration, say he no dey show workings at all for matter wey concern pipo welfare. He fry mouth on top di matter for one press conference for Umuahia on Thursday, say many policies of di current government no dey touch di life of ordinary people for ground. Di PDP candidate spoil […]

todayJuly 2, 2026 23

OBODO NAIJA

FG Announce Big NYSC Reform Say Adire Go Replace Khaki Uniform

Federal Gornment don announce say dem dey plan for major changes for NYSC programme, and one of dia plan na to replace di traditional khaki uniform with locally made Adire material to support Naija economy. Na Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, announce dis one for TV siddon tuk on Thursday, He tuk say di reform go ensure say corpers go receive postings wey match dia course of study. E […]

todayJuly 2, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds