OBODO NAIJA

770 Results / Page 46 of 86

Background

OBODO NAIJA

Soldiers Burst Secret Gun Factory For Kebbi, Gbab Two Jaguda Boys

Soldiers under Operation FANSAN YAMMA don burst one secret gun factory for Kebbi State, recover five locally-made AK-47 rifles, and grab two suspected gun makers wey dey supply terrorists with weapons. Confirming di operation for inside statement on Thursday, di Media Information Officer of Operation FANSAN YAMMA, Lt. Col. Aliyu Danja, tok say di soldiers plan well well before di operation. According to di military, na correct intelligence make dem trace […]

todayJuly 2, 2026 15

OBODO NAIJA

Schools Reopen For Oyo State As Teachers End One-Month Strike

Public schools for Oyo State don reopen today after di Nigeria Union of Teachers (NUT) announce on Wednesday say dem don suspend di one-month strike. As dem suspend di strike, NUT Presido, Titus Amba, say di decision come after di union hold talks with di government and also consider say plenty children don stay house for several weeks because of di kidnapping incident. Di union bin direct all public primary […]

todayJuly 2, 2026 19

OBODO NAIJA

Obasanjo Warn Say Make Nigeria No Allow Civil War Again

Former President Olusegun Obasanjo don warn say plenty of di things wey cause Nigeria Civil War for 1967 still dey ground, and everybody must join hand make dat kind wahala no happen again. Obasanjo tok dis one on Wednesday as e receive book, research materials, videos and interviews about di Asaba Massacre from Chief Chuck Nduka-Eze for di Olusegun Obasanjo Presidential Library, Abeokuta. E praise Nduka-Eze for keeping di history […]

todayJuly 2, 2026 20

OBODO NAIJA

NDC  Upload Peter Obi Name As Dia Presidential Candidate for 2027

By : Jolayemi Olajide Unto election 2027 waka, say di breeze don blow reach di Nigeria Democratic Congress (NDC),  like dis,  dem  don successfully upload di papers of dia presidential candidate,  Peter Obi, enter di INEC portal. Di National Leader of di party, Sen. Seriake Dickson, break di news for im 'X' handle and explain say everything dey waka uniform with di INEC timetable. Dickson tuk say di name of […]

todayJuly 1, 2026 9

OBODO NAIJA

 FG Tell Nigerians For South Africa Not To Fear, Say Dem Dey With Dem

Federal Gornment don assure Nigerians wey still dey South Africa say dem safe, even as fresh xenophobic protest don raise fear across di country. Another 269 Nigerians wey government evacuate don land Lagos from Johannesburg, while reports say gunmen kill one Nigerian businessman wey dem sabi as Big Joe for Mpumalanga. Thousands of South Africans march for different cities, dey demand make undocumented foreigners comot, as police deploy security to […]

todayJuly 1, 2026 17

OBODO NAIJA

Fuel Sellers Say Dem Go Lock Pump If FG Control Price

Problem dem say e nor dey finish oh, dat Fuel marketers don sama beta warning give federal gorment say, if dem get two head, try am, control dia petrol pump price, dem go luck filling station. Oga tuk, tuk, IPMAN, di fuel sellers, Chinedu Ukadike, naim use im yamchop mouth tuk dis one, say dem nor go accept any policy wey go force dem sell fuel for fixed price. Di […]

todayJuly 1, 2026 16

OBODO NAIJA

First Lady, Oluremi Launch Food Bank For Jigawa To Fight Hunger

Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, aka, na awa mama be dis, don go show motherly love launch North-West National Community Food Bank for Hadejia inside Jigawa State to fight hunger and malnutrition. She talk say dis ogbonge program na to hellep take care of  small pikins, pregnant women, and mothers wey dey breastfeed for ijgawa Matagbon, the First Lady come beg all the state gornment-dem for the region make […]

todayJuly 1, 2026 16

OBODO NAIJA

APC Govs Vow To Fix Democracy, Make Life Better For Nigerians  

By: Yusuf Abuh Gofnors wey dey under All Progressives Congress (APC) for Progressives, Governors Forum (PGF) don agree say dem go join hand solve di challenges wey dey affect Nigeria democracy. Chairmo of di forum, Gofnor. Hope Uzodimma tok dis one after dia meeting wey end early Tuesday morning for Abuja. E still say di govos promise to work, make life beta for Nigerians and improve governance across di country.

todayJuly 1, 2026 14

OBODO NAIJA

Federal Gornment To Scrap JSS-SSS For Secondary School

Di Minister of Education, Dr. Tunji Alausa, don drop micro soft word say gornment go stop di policy wey dey separate Junior Secondary Schools from Senior Secondary Schools. According to FG di reason why dem do am like dat don fail. Oga minister of education yan dis one as dem announce di Ministerial Committee for Abuja on Tuesday. Di explanation go shock u,  say policy make children drop out from […]

todayJune 30, 2026 18 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds