OBODO NAIJA

770 Results / Page 59 of 86

Background

OBODO NAIJA

Police begin touchlight how Popular Businessman “Egonaejeije” take kpai inside Abuja House!

By : Jolayemi Olajide Police for Abuja don begin dig inside mata of how pipo kpai one big electronics businessman, Chief Godwin Chinedu Lucky Adimike, wey many people know as “Egonaejeije Na Awka-Etiti.” The 53-year-old businessman, wey get big face for Alaba International Market for Lagos, kpai for Karu General Hospital after dem find am with heavy wound for im house for Hassan Adamu Street, Guzape district. Dis sad level […]

todayMay 25, 2026 28

OBODO NAIJA

President Tinubu wipe Osifo, collobi APC Ticket for Second Term Race

By : Jolayemi Olajide Oya hear the big gist for Abuja, as Baba Presido, Bola Tinubu don grab di APC ticket again, to run for second term inside the next election. Tinubu win dis primary election with big score wey dey throw backy, dey look opponent dey laugh, say dem nor reach. Di senior man presido collobi  10.9 million votes to flog di only challenger, Stanley Osifo, wey only get […]

todayMay 25, 2026 16

OBODO NAIJA

Gunmen attack Kwara prayer house, kpai 3, carry 15 go

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin oh, na so Some jaguda boys go kpokpo one  prayer house for Ori-Oke Ajaiye, near Ikiran village inside Ekiti Local Government Area of Kwara State, on Saturday night. According to report, di bad boys attack, di pipo when dem dey do night vigil,  dem kpai three worshippers and carry 15 other pipo go bush. The Kwara State Police Command, through dia tuk, […]

todayMay 25, 2026 18

OBODO NAIJA

Police Arrest Officer Wey Threaten To Shoot Pipo Wey Video Am For Anambra

By : Jolayemi Olajide Anambra State Police Command don gbab one police officer wey make shakara for inside viral video, dey tuk say im go shoot anybody wey try record am as im dey work. Dem reveal say di officer name na ASP Newton Isokpehi and dem don open disciplinary case for him head sharp-sharp. Na Deputy Commissioner of Police, Ngozi Ezeabata, release di statement on behalf of di big […]

todayMay 22, 2026 18

OBODO NAIJA

Presidency Say Tinubu Nor Get Plan To Change Naija Name Or Cancel Sharia

By: Jolayemi Olajide Presidency don clear di air say President Bola Tinubu nor get any plan to change Naija name or comot Sharia Law for northern states. Baba Special Adviser wey be number one tatafo,, Bayo Onanuga, naim clear di  air for statement on Thursday Onanuga tuk say some desperate politicians na dem fabricate di story just to cause wahala, fear, and confusion inside di country sake of di 2027 […]

todayMay 22, 2026 26

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail NDLEA As Dem Scatter Heavy Nigerian-Mexican Drug Ring

By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don hail di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) afta dem burst one big Nigerian-Mexican drug cartel and scata dia multi-million-dollar business. Di President salute dem inside one statement wey im number one tatafo, Bayo Onanuga, release on Thursday for Abuja. NDLEA Oga, retired Brig.-Gen. Buba Marwa, bin announce on Wednesday how dem take catch di bad guys afta weeks of […]

todayMay 22, 2026 22

OBODO NAIJA

How Senator Adeola Take Use 300k Votes Take Win Ogun APC Governorship Ticket

By : Jolayemi Olajide Senator wey dey represent Ogun West, Solomon Adeola, don win di APC ticket to contest for di 2027 governorship election for Ogun State. Oga Chairmo of di primary election committee, Wale Ohu,  naim announce di result for Abeokuta afta Adeola pack 304,055 votes, while his opponent, Abayomi Hunye, get zero vote. Out of di 305,287 voters wey come out to vote inside di 20 local government […]

todayMay 22, 2026 19

OBODO NAIJA

Governor Oyebanji And 11 Others Sign Peace Paper For Ekiti Election

By : Jolayemi Olajide  Baba govo of Ekiti State, Biodun Oyebanji on Thursday don promise say everywia go soft and peace go reign before, during, and afta di June 20 governorship election for Ekiti State. Oyebanji tuk dis one for Ado-Ekiti inside one meeting wia im and 11 other governorship candidates sign peace paper for di election. Di National Peace Committee and INEC naim  arrange di peace meeting, and big […]

todayMay 22, 2026 37

OBODO NAIJA

Na Only Pipo Wey No Understand Politics Go Believe Say I Be Tinubu Boy- Kwankwaso

By : Jolayemi Olajide Former Kano State Govo and National Democratic Congress leader, Rabiu Musa Kwankwaso, don deny claim say e dey secretly work for President Bola Tinubu ahead of 2027 presidential election. E talk dis one for TV siddon tuk, where e say people wey dey spread di talk no really understand politics at all. E still talk say him and him supporters dey work for NDC and for […]

todayMay 21, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds