OBODO NAIJA

770 Results / Page 57 of 86

Background

OBODO NAIJA

NAPPS for Oyo State comot hand say dem nor dey protest for victims of oyo kidnap

By : Jolayemi Olajide Di National Association of Proprietors of Private Schools (NAPPS) for Oyo State don comot hand flat from the protest wey dey happen for Ibadan over the security wahala inside the state. Oga of di private schools, Olukonle Fajobi naim soroshoke to tatafo, so though di mata dey pain dem and dat portest nor be di answer to di situation. He con stand strong say make everybody […]

todayJune 2, 2026 29

OBODO NAIJA

Wike Burst Bubble Say Amaechi Make Mistake Join ADC Presidential Race

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike don drop micro soft word say, former Rivers State Govo, Rotimi Amaechi, dey big boy, oganaogan, con make serious mistake by contesting for 2027 presidential ticket under ADC platform. Di senior man yarn dis one for  im monthly media chat for Abuja on Monday Wike  say if to say  Amaechi  ask,  im for advice am  before joining di race, e for tell […]

todayJune 1, 2026 18 1

OBODO NAIJA

MAPOLY Sack 365 HND Students Say dem use Fake Results enter school

By : Jolayemi Olajide Nor be small jogolo for Abeokuta, wia Authorities of Moshood Abiola Polytechnic (MAPOLY) don serve about 365 HND students break fast, sake of say dem use fake results enter di school. Na di school tuk, tuk person, Yemi Ajibola, naim do dis tatafo wey konfam news carry on Monday. According to school management, dis childrensis get mind deceive di school. After touch lighting, e con be […]

todayJune 1, 2026 17

OBODO NAIJA

Defence Minister Score Tinubu Gorment 70% For Security

By : Jolayemi Olajide Defence Minister,  Christopher Musa, don  drop micro soft word say wi oga Presido, Bola Tinubu  na senior man im be for security. Dat if im na teacher im go score baba seyi administration between 65 to 70 per cent on top security mata. Musa yarn dis one for  live TV on Friday  as Wi oga presido dey mark three years for office, say regular terrorism don […]

todayMay 29, 2026 26

OBODO NAIJA

NANS Plan protest on Monday for Oyo state  Students, Teachers wey jaguda kidnap

By : Jolayemi Olajide Meanwhile,  Presido of National Association of Nigerian Students, Akinteye Babatunde, don announce give student across obodo naija say on Monday, all of dem go come out do we nor go gree, we no go gree protest for di release of  Oyo State students wey Jaguda boys  over di kidnap. For one invitation wey im release on Friday, Akinteye talk say di steady maltreatment wey dey jaguda […]

todayMay 29, 2026 20

OBODO NAIJA

Oyo APC Blast Makinde Over Kidnap, Killing and Security Wahala for State

By : Jolayemi Olajide Di Oyo State chapter of di All Progressives Congress (APC) don cry out again over di regular kidnapping, killing, and fight-fight wey dey hapun without any break  for di state. Inside one statement wey di party Publicity Secretary, Olawale Sadare, release for Ibadan, APC talk say things dey go wrong sake of say di govo Seyi Makinde l dey do eye-service and politics with security. Di […]

todayMay 29, 2026 25

OBODO NAIJA

NYSC warn Corpers to avoid internet scorscor doings

By : Jolayemi Olajide NYSC Director-General, Brig. Gen. Olakunle Nafiu, don warn corps members during Abuja interview on Thursday say national service no exempt them from Nigeria cyberbullying laws. Im drop dis warning through the tatafo pipo sake of say some corpers dey use social media misbehave, thinking say uniform go hide dem. Di DG clear di air say police go arrest any corper wey go break di law with […]

todayMay 28, 2026 25

OBODO NAIJA

Cubana Chief Priest explain why im sti dey loyal to President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Senior man influencer, wey be billionaire, Cubana Chief Priest don explain imself for Lagos, say im sti dey support President Bola Tinubu and APC. Di seniorman celebrity barman tuk dis one for one radio interview explaining say, im political waka just dey start even though say im lose the APC ticket for Orsu/Orlu/Oru East federal constituency. Cubana say naija politics mata im spread wetin nor good […]

todayMay 28, 2026 17

OBODO NAIJA

Sowore Scatta Table Say Make Nobody Trust INEC

By: Esther Ayoola Human rights activist Omoyele Sowore don untop election mata wipe INEC cord for neck, say im nor trust dem. Sowore yarn dis one for media chat wey hapun today, dat INEC nor dey free and fair but hope say dem go change for 2027. According to am, di figures wey dem dey announce for election no dey always correct, and e believe say Naija pipo naim get […]

todayMay 28, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds