OBODO NAIJA

770 Results / Page 58 of 86

Background

OBODO NAIJA

Federal High Court Go Dey Open Weekend For Election Case Filing

By: Esther Ayoola Federal High Court of Naija don order say all dia registries for every division across di kontri go dey open weekends and public holidays from 10am reach 2pm to collect only pre-election matter papers ahead of 2027 general elections. Chief Registrar of di court, Yahaya Shafa, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday, say dem do am because di time wey law give for […]

todayMay 28, 2026 20

OBODO NAIJA

Lagos Police Burst Kidnap, Robbery Gangs, Kpai Four Suspects for Gun Battle

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police don knack chest say dem block one major gbege for inside the state, as dem burst serious kidnap and robbery gangs, come kpai four suspects during heavy gun battle. The Senior Man for the Command, Commissioner of Police Tijani Fatai, naim yan this one give aproko people during dia monthly press briefing for the Force Headquarters. According to CP Fatai, the gallant operatives […]

todayMay 26, 2026 17

OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election. The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress. As if dat one no […]

todayMay 26, 2026 27

OBODO NAIJA

 Police and local hunters kpai three kidnappers, rescue victim for Oyo State

By : Jolayemi Olajide Oyo State Police Command don tuk say dem Rambo style kpai three suspected kidnappers and rescue one person wey dem bin kramp for Otu area inside Oke-Ogun axis. Di police tuk, tuk, DSP Ayanlade Olayinka, clear dis one for statement wey im release on Tuesday. Dem talk say the heavy operation hapun after local hunters call dem for help on Monday, May 25, 2026, when the […]

todayMay 26, 2026 22

OBODO NAIJA

Tinubu salute Muslims for Eid, say goment dey work round di clock to fix Naija

  By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure Nigerians say all the reforms wey im goment dey do go continue and dat im dey mout mehn to handle security, steady economy, and progress. Inside im 2026 Eid-el-Kabir message wey comout on Tuesday before Wednesday celebration, baba Seyi salutate all Muslims for Nigeria and across di world. Tinubu talk say true-true, im know say some areas still […]

todayMay 26, 2026 26

OBODO NAIJA

US Bomb Iran Again As Peace Tuk Dey Happen For Qatar

By: Esther Ayoola America don launch fresh air strikes for southern Iran, even as top Iran negotiators gather for Qatar to discuss peace deal with Washington. US military tuk say dem carry out di attack to protect dia soldiers from threats by Iranian forces, while di targets include missile launch sites and boats wey bin dey waka kukere waka for sea. Iranian sources sti claim say some IRGC fighters die […]

todayMay 26, 2026 15

OBODO NAIJA

INEC Beg Appeal Court To Trash Judgment Wey Stop Dia May 10 Deadline

By: Esther Ayoola Aba, INEC don rush go Court of Appeal for Abuja to tell dem say make dem throway dat judgment wey Federal High Court give on May 20. Dis one dey happen afta Justice Muhammed Umar void di new rules wey INEC set, wey force political parties say make dem submit dia membership register by May 10 before dem fit join di 2027 election. Na one political party […]

todayMay 26, 2026 17

OBODO NAIJA

APC Boast Say Dem Go Pull Over 10 Million Votes Again For Tinubu

By: Esther Ayoola Oya, look wetin dey sup for politics: Di National Chairmo of APC, Nentawe Yilwatda, don rake full newspaper say im party go collobi pass 10 million votes for di 2027 presidential election. Yilwatda yarn dis one for TV sit down tuk on Monday afta President Bola Tinubu win di party presidential primary with 10.9 million votes. Im explain say, di reason why im dey get dis kind […]

todayMay 26, 2026 20

Health

No Chop “Ata Esha” Again! Aproko Doctor Warn Say Spoilt Tomatoes Dey Cause Liver Cancer!

By : Jolayemi Olajide Popular health influencer, Dr. Chinonso Egemba wey everybody know as Aproko Doctor, don warn Nigerians on Monday make dem stop to dey buy and chop spoilt tomatoes wey people dey call “Ata Esha” or “Awarawa.” Inside one heavy health advisory wey roll for his X account, di doctor talk say those white-white things inside di rotten tomatoes na fungus wey dey produce one dangerous poison called […]

todayMay 25, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds