obodo oyinbo

335 Results / Page 29 of 38

Background

obodo oyinbo

US And Iran To Put Bodi For Meeting To Settle Dia Quarrel Today

By: Esther Ayoola US and Iranian top official say, dem go meet for Oman today to calm tension between di two. Say Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don waka go Muscat for di talks. For U.S. side, Trump pipo like Steve Witkoff and Jared Kushner go join di meeting, say if nothing come out from dis meeting, war go fit start between di two countries.

todayFebruary 6, 2026 35

obodo oyinbo

Iran Presido Pezeshkian Konfam Dia Tuk Wit USA

By: Esther Ayoola Iran Presido, Masoud Pezeshkian on Tuesday say im don ready to start tuks wit United States, if only di tuk nor go bring problem to Iran. US Presido, Donald Trump, bin warn Iran say “bad things go hapun” if Iran nor strike Nuclear deal with dem. Arab official wey no give im name, say dem fit meet for Turkiye on Friday for di tuks, as Egypt, Qatar, […]

todayFebruary 4, 2026 18

obodo oyinbo

UN Beg Israel to Allow Sick Pipo Enter Egypt

By: Esther Ayoola U.N. boss, Antonio Guterres don beg Israel make dem allow humanitarian hellep enter Gaza. Say Plenty pio dey sick and dey wunjured for GAZA, dey wait opportunate to cross go Egypt for treatment. Based on say Isreal nor gree, say na Only small number, 16 pipo, waka go Egypt on Tuesday. Dis one sef far from di 50 pipo wey Israel agree say dem go allow go […]

todayFebruary 4, 2026 13

obodo oyinbo

U.S. Raise Alarm Over Nigeria Religious Crisis

By: Esther Ayoola Pipo wey suppose tuk for United States Congress Foreign Affairs Committee don send dangerous warning say if care is not taken, Naija Christians and Muslims go enter kwanta. Dem say di country fit become one big bone for neck wey go dey face religious freedom fight. Say like dis, dis mata dem wan discuss am for di hearing wey dem call ‘Defending Religious Freedom Around the World’ […]

todayFebruary 4, 2026 12

obodo oyinbo

President Trump Slash India Tariff Go 18% From 50%

By: Esther Ayoola President Donald Trump don drop ogbonge update, say US go cut tariff wey dem dey charge Indian goods from 50% to 18% afta meeting with Prime Minister Narendra Modi. India come agree say, dem nor go dey buy Russian oil again and dem go dey buy oil from US and maybe Venezuela. According to Trump, dis waka with India go reduce trade barriers and India go dey […]

todayFebruary 3, 2026 17

obodo oyinbo

Iran, US Set Tuk For Istanbul To Avoid War

By: Esther Ayoola Iran say dem dey hope for progress to start nuclear tuk wit US again. Some people dey tuk say di Iran president don order make dem revive di negotiations. Tehran dey look tori wey some countries for di area bring come and dat e don reduce tension wit Washington. Reuters Report, say US and Iran go meet for Istanbul on Friday, US envoy Steve Witkoff and Iran […]

todayFebruary 3, 2026 12

obodo oyinbo

Green Fuel Wahala Slow Down Airline Industry

By: Esther Ayoola Di airline industry green plan, say dey face serious problem as cleaner jet fuel price dey go up like say tomorrow nor dey . IATA boss Willie Walsh tuk for Changi Aviation Summit for Singapore say progress on sustainable aviation fuel still dey poor. According to am, SAF production for 2025 na only 1.9 million tonnes, wey be just 0.6 percent of total jet fuel wey airlines […]

todayFebruary 2, 2026 12

obodo oyinbo

NGOs Reject Israel Demand To Staff Details Before Go Ahead To Hellpe Gaza

By: Esther Ayoola Israel don tighten pressure on international aid groups wey dey hellep Palestinians, as plenty NGOs say dem no go follow new order to submit staff details for Gaza and other occupied areas. Eight groups, plus Oxfam and Doctors Without Borders, tuk say, giving worker names fit put dia pipo for serious danger. One NGO call am “red line,” say dem no go risk staff lives just to […]

todayFebruary 2, 2026 11

obodo oyinbo

Landslide Kill Over 200 Small Miners For Rubaya Mine Inside DR Congo

By: Esther Ayoola For Democratic Republic of Congo, gornment say nor be small tin dey hapun for dia kontri dat, one wicked landslide kpai kpai Miners for one militia base for eastern part of di country wey Armed group  dey control, say na at least 200 pipo dey feared dead. M23 armed group don capture plenty land for eastern congo since 2021, including Rubaya mine for North Kivu with hellep […]

todayFebruary 2, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds