obodo oyinbo

429 Results / Page 27 of 48

Background

obodo oyinbo

Trump Promise To Burn Iran Plant If Dem No Open Strait Of Hormuz

US Presido, Donald Trump,  like dis now dey threaten say e go fit destroy Iran power plants and bridge if dem no open Strait of Hormuz by Tuesday. Im tuk dis one for im truth socials, dat if Iran nor behave demselves e fit release "hell", but believe say deal fit hapun with Tehran. Iran on dia own part dey laugh Trump threat, dem call am "helpless, nervous and stupid." […]

todayApril 6, 2026 17

obodo oyinbo

Iran Raise Alarm For Strait of Hormuz Security Vote Postponement

Iran don warn di UN Security Council say make dem nor do any “provocative action”, ahead of a scheduled vote wey dem wan take settle di wahala for strait of Hormuz. Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi na drop dis yarnings ahead of di Security Council suppose vote on draft resolution. Say di resolution na to hellep create force to secure di shipping lane wey dey vital to global energy supply. […]

todayApril 3, 2026 25

obodo oyinbo

US- Israel Continue attack in Iran, kpaiing Many Pipo

Say US and Israel don increase attack for Iran, dem target old medical research centre for Tehran, one bridge near di capital, plus steel plants. Dis one sef dey come after U.S Presido, Donald Trump promise Iran say im go take Iran  back “Stone Ages.” For Iran military, say di war go continue until dia enemies shame and surrender.

todayApril 3, 2026 17

obodo oyinbo

President Trump Fire AG Pam Bondi, Put Lawyer Todd Blanche As Acting Boss

US Presido Donald Trump don fire Attorney General Pam Bondi on Thursday for Washington, DC. Trump tuk for Truth Social say Bondi na “Great American Patriot” wey do beta work, but she gat move enter private sector. Trump con put im former personal lawyer, Todd Blanche, as acting boss for Justice Department to replace her. According to aproko from America, some supporters  dey vex because of how Bondi handle the […]

todayApril 3, 2026 23

obodo oyinbo

Iran Yarn Say Dem Go Hit US Hard After Trump Threaten Dem

On Thursday, Iran yarn say dem go give US and Israel crashing attacks, as dem fire missile reach Tel Aviv after US President Donald Trump talk say dem go bomb Iran “back to Stone Ages.” Di fight don dey since US and Israel start strike Iran over one month ago, e don spread for whole Middle East, dey shake global economy, affect plenty millions pipo worldwide. For White House talk, […]

todayApril 2, 2026 19

obodo oyinbo

UN Question Di Death Of 3 Indonesian Peacekeepers For Lebanon

All 15 members for UN Security Council don condemn di wahala wey make three Indonesian UN peacekeepers kpai die for Lebanon. Di council tok dis one for join bodi statement, say di incidents happen for UNIFIL area for south Lebanon, including two deadly explosions, as fighting dey go on along di Blue Line between Israel and Lebanon. Dem wish di injured quick recovery, praise all UN peacekeepers wey dey risk […]

todayApril 2, 2026 19

obodo oyinbo

Israel Hit Lebanon Hard, Kpai Top Hezbollah Commander

Say like dis Israel don increase dia attack for Lebanon dis week, hitting places outside Hezbollah on Tuesday. According to reports, Dem strike one vehicle north of Beirut plus Jnah area for di middle of di capital. For di south and di suburbs, wey Hezbollah strong, dem sti dey hit places; one building for road to Beirut airport collapse afta dem evacuate di pipo wey dey inside. Israel say dem […]

todayApril 1, 2026 27

obodo oyinbo

Italy Sport Minister Tell Italy Football Ogas To Resign

By: Esther Ayoola Italy Sport Minister Andrea Abodi like dis don wire di head of football federation to resign afta Italy miss World Cup again. Italy lose for play-off to Bosnia-Herzegovina and no enter di USA, Canada, Mexico World Cup dis summer. Football oga , Gabriele Gravina tuk say e no wan resign, but di board go meet next week to decide im marras. Abodi dey insist dat dem need […]

todayApril 1, 2026 19

obodo oyinbo

Iran Revolutionary Guards Threaten Apple, Google, Tesla If More Leaders Kpai

Iran Revolutionary Guards like dis, don cut chain say if more of dia top Iranian leaders kpai sake of dis war, dem go target big US tech companies like Apple, Google, Meta, Microsoft, Tesla and others. Say dem drop microsoft word for di workers for these companies make dem avoid office starting Wednesday 8:00 pm Tehran time to save dia life. Di Iran guards dey claim say, these companies dey […]

todayApril 1, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds