obodo oyinbo

580 Results / Page 27 of 65

Background

obodo oyinbo

Ukraine Accuse Russia say Dem Use Girls Target Dem

  By : Shalom Ovie Ukraine police boss don accuse Russia say dem dey recruit teenage Ukrainian girls to carry out attacks against Ukrainian soldiers, after dem arrest one 17-year-old girl wey link to poisoning and killing of one soldier. For interview wey Ukrainian news outlet Cenzor.NET publish, Ivan Vyhivskyi talk say Russian agents don arrange 6 contract killings this year through Telegram, and Ukrainian authorities only manage block 1 […]

todayJune 11, 2026 25

obodo oyinbo

US, Iran Exchange Blow

US Presido Donald Trump, don cut chain say United States go hit Iran “hard” again after both sides exchange strikes overnight. Di white house presido put dis one for X, say dis action na based on say Iran go shoot down US Army helicopter. Iran President Masoud Pezeshkian respond for X say Iran go stand firm against any pressure or threat from America, showing say dem no go back down. […]

todayJune 11, 2026 20

obodo oyinbo

Gunmen Kpai 12 For south africa, Police Launch Investigation

By : Shalom Ovie Nor be small jogolo for south Africa, say Twelve pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter  different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi,  say di suspects escape, while investigators begin touch light  wetin really play for di area.

todayJune 10, 2026 20

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Backyard Movement

Baba Presido of America, Donald Trump drop one or two on Tuesday say hand go touch Iran, say e nor get wetin person go tell am,  hand go touch Iran say dem get mind shoot down one US military helicopter wey dey patrol near Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social on Tuesday say, im hear report say di attack hapun for night, even as dem dey try […]

todayJune 10, 2026 19

obodo oyinbo

Ebola protest turn violence for Kenya

By : Olajide Jolayemi Kenyan police fire teargas and arrest several protesters during a heated protest against an Ebola isolation centre wey America dey build for Nanyuki town, near Laikipia Air Base. Di protesters, including local residents, carry fake coffin and wear protective gear to block di area, saying dem no want anything wey fit bring Ebola enter Kenya. According to security sources and eyewitnesses, di clash turn violent as […]

todayJune 9, 2026 12

obodo oyinbo

Iran Drag US Over World Cup Ticket Wahala

By : Jolayemi Olajide Iran Football Federation don accuse United States say dem withdraw di World Cup tickets wey belong to Iranian fans just few days before di 2026 tournament start. Di federation say FIFA rules give every participating country 8 percent of match tickets, but dem suddenly collect Iran own allocation back after fans don already buy tickets and make travel plans. Dem also complain say visa wahala don […]

todayJune 9, 2026 19

obodo oyinbo

JOHESU Threaten Fresh Strike, Say Federal Govment Nor Pay Health Workers Better Salary

By: Esther Ayoola Gbege dey oh, our number one bodi mata pipo, Joint Health Sector Unions don dey warn say dem go strike oh, as Federal Gornment nor gree do wetin dem to increase dia salary. Na dia National Chairmo, Kabiru Minjibir, dey sorosoke dis tori to journalists on Tuesday for dia 114th International Labour Conference for Geneva, Switzerland. According to am, health workers don dey fight for di salary […]

todayJune 9, 2026 13

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 […]

todayJune 9, 2026 9

obodo oyinbo

Heavy 7.8-Magnitude Earthquake Hit Philippines, Kpai 15 Pipo

By : Jolayemi Olajide Chai, heavy  problem for  southern Philippines on Monday, dat  one massive 7.8-magnitude earthquake shake the area. Dis na according to di United States Geological Survey, and USGS, wey konfam di mata, and  at least 15 pipo don kpai  near General Santos City. According to Philippine authorities, the earthquake hapun inside water for the southern part of the city. Based on dis,  Philippine gornment  don  order make  […]

todayJune 8, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds