obodo oyinbo

429 Results / Page 40 of 48

Background

obodo oyinbo

Iran, US Set Tuk For Istanbul To Avoid War

By: Esther Ayoola Iran say dem dey hope for progress to start nuclear tuk wit US again. Some people dey tuk say di Iran president don order make dem revive di negotiations. Tehran dey look tori wey some countries for di area bring come and dat e don reduce tension wit Washington. Reuters Report, say US and Iran go meet for Istanbul on Friday, US envoy Steve Witkoff and Iran […]

todayFebruary 3, 2026 13

obodo oyinbo

Green Fuel Wahala Slow Down Airline Industry

By: Esther Ayoola Di airline industry green plan, say dey face serious problem as cleaner jet fuel price dey go up like say tomorrow nor dey . IATA boss Willie Walsh tuk for Changi Aviation Summit for Singapore say progress on sustainable aviation fuel still dey poor. According to am, SAF production for 2025 na only 1.9 million tonnes, wey be just 0.6 percent of total jet fuel wey airlines […]

todayFebruary 2, 2026 12

obodo oyinbo

NGOs Reject Israel Demand To Staff Details Before Go Ahead To Hellpe Gaza

By: Esther Ayoola Israel don tighten pressure on international aid groups wey dey hellep Palestinians, as plenty NGOs say dem no go follow new order to submit staff details for Gaza and other occupied areas. Eight groups, plus Oxfam and Doctors Without Borders, tuk say, giving worker names fit put dia pipo for serious danger. One NGO call am “red line,” say dem no go risk staff lives just to […]

todayFebruary 2, 2026 20

obodo oyinbo

Landslide Kill Over 200 Small Miners For Rubaya Mine Inside DR Congo

By: Esther Ayoola For Democratic Republic of Congo, gornment say nor be small tin dey hapun for dia kontri dat, one wicked landslide kpai kpai Miners for one militia base for eastern part of di country wey Armed group  dey control, say na at least 200 pipo dey feared dead. M23 armed group don capture plenty land for eastern congo since 2021, including Rubaya mine for North Kivu with hellep […]

todayFebruary 2, 2026 14

obodo oyinbo

South Africa Show Israel Diplomat Door, Give Am 72 Hours to Comot

By: Esther Ayoola South Africa don declare Israel top diplomat for di country, Ariel Seidman, persona non grata and give am 72 hours to comot. Di foreign ministry talk say na because e don break plenty diplomatic rules and even dey attack President Cyril Ramaphosa for Israeli official social media. U sabi say, Tension don dey between South Africa and Israel since South Africa carry case go United Nations last […]

todayJanuary 30, 2026 15

obodo oyinbo

Colombia Lawmaker, 14 Others Kpai For Plane Crash Near Venezuela Border

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for America, say, one Plane, wey dey bin dey fly from Cúcuta to Ocaña for Colombia don go crash for mountain near Venezuela border, kill all 15 people wey dey onboard, including lawmaker Diógenes Quintero. Di state‑owned airline Satena ni konfamate dat, di small plane lose contact with air traffic control before e hit ground and  no bodi survive di crash. According to […]

todayJanuary 30, 2026 11

obodo oyinbo

Trump Tell Putin To Stop Firing Kyiv For Di Next 7 Days

By: Esther Ayoola Ukraine Presido, Volodymyr Zelenskyy, nor bi small happiness for am yesterday, say Donald Trump tell Russia to stop attack on Kyiv and some other towns for seven days. Zelenskyy tuk say, im support Trump and dat, e go hellep protect pipo during di cold winter. Dis pause for bombing dey come afta di leaders  tuks for United Arab Emirates, say, di next tin na to reach peace […]

todayJanuary 30, 2026 12

obodo oyinbo

Iran Ready To Strike US If Gbege Happen

By: Rilwan Agbomeji Iran foreign minister, Seyed Abbas Araghchi don yarn say Iranian army dey ready to immediately and powerfully strike back if US try attack dem. Di warning land just hours afta US Presido Donald Trump yarn again say dem fit carry military action come. Di USS Abraham Lincoln, one nuclear-powered aircraft carrier, na one of di many military tins wey US don send go Arabian Sea these past […]

todayJanuary 29, 2026 16

obodo oyinbo

Starmer Land China, Seek Beta Trade And Fresh UK–China Relationship

By: Rilwan Agbomeji UK Prime Minister Keir Starmer don waka go China for three days visit, becoming di first UK PM to go dere since 2018. E travel with about 60 British business and culture leaders, and e go meet Chinese President Xi Jinping to talk about trade and beta relationship. Inside di plane, Starmer tell reporters say e wan correct and steady China policy. Dis visit show say di […]

todayJanuary 28, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds