Sports

529 Results / Page 4 of 59

Background

Sports

Peseiro Insist Say Lookman Na Di Same Level E Dey With Osimhen For Super Eagles

By: Esther Ayoola Former Naija coach José Peseiro say, Ademola Lookman don dey match Victor Osimhen for Super Eagles doings. Di former coachie di narrate dis to tori pipo on Thursday. Peseiro say Lookman don show say, e fit be di main man for Atlético Madrid too. E mention say Lookman don score plenti goals for AFCON and even carry Atalanta win Europa League final with hat-trick, derefore say na […]

todayFebruary 13, 2026 16

Sports

Promoter Eddie Earn Konfamate Dat Anthony Joshua Moral Low

By: Esther Ayoola Anthony Joshua promoter, Eddie Hearn, don drop bumbshell, say e no sure whether Joshua go fight again after im lose two close padi for car crash for Naija. Joshua don dey try enter gym small, but e never sti do any proper training for boxing. U sabi say, afta e knock Jake Paul finish, Joshua travel come visit family, but wahala sup, when im car get askident, […]

todayFebruary 13, 2026 5

Sports

Arsenal Lead Shrinks to 4 Points After 1-1 Draw with Brentford

By: Esther Ayoola Arsenal don dey shakibalaba, seeing dia lead for top of Premier League reduce to just four points afta playing draw 1-1 with Brentford for Gtech Community Stadium Thursday night. Noni Madueke ni even score first with header for Arsenal around 60th minute. But Keane Lewis-Potter come score header ten minutes later making di game square.

todayFebruary 13, 2026 7

Sports

CAF Send Technical Team Go Check Tanzania, Uganda, Kenya For 2027 AFCON

By: Rilwan Agbomeji CAF don send team of technical people go check stadiums and oda facilities for di three countries wey go host 2027 Africa Cup of Nations, Tanzania, Uganda, and Kenya. Dem win di bid wey dem dey call PAMOJA 2027, pass di joint bid wey Nigeria and Benin Republic put. Untop yarnings with tori pipo, CAF Presido, Patrice Motsepe say AFCON go come every four years afta 2028, […]

todayFebruary 12, 2026 8

Sports

Spurs Sack Thomas Frank Based On Bad Home Form

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don sack dia manager Thomas Frank afta dem lose 2-1 for house to Newcastle on Tuesday night. Dis one dey inside Sky Sports news, di Danish coach wey join Spurs last summer from Brentford leave di club as dem dey struggle for 16th position for Premier League table, just five points above relegation zone. Spurs never win any league match for 2026 and dia home […]

todayFebruary 11, 2026 8

Sports

Sesko Last-Minute Goal Rescue Man United From West Ham

By: Esther Ayoola Manchester United wait for five wins a row continue afta playing 1–1 draw with West Ham for London Stadium on Tuesday night. West Ham take di lead for second half as Tomáš Souček score for 50th minute. United nor gree for anybody, fightback beta style as Benjamin Sesko score equaliser for injury time, 90+6 minute. Di Result mean say, United four straight wins under interim coachie Michael […]

todayFebruary 11, 2026 5

Sports

Update – NSC Launch LOC For Abuja 2027 African Schools Games

By: Esther Ayoola Wi National Sports Commission (NSC) officially don inaugurate 28-member Local Organising Committee (LOC) for di second African Schools Games wey go shelle, for 2027. NSC Chairman, Mallam Shehu Dikko, tuk dis tuk on Tuesday, say, dem dey give di LOC  work to deliver successful Games. According to Dikko, planning, coordination, transparency and teamwork go make di Games safe and memorable for all young athletes. Also on Tuesday, […]

todayFebruary 11, 2026 4

Sports

Ukrainian Athlete Get Permission To Wear Black Armband For Olympics

By: Esther Ayoola For Milan Cortina Winter Olympics, Ukrainian skeleton racer Vladyslav Heraskevych don get di go ahead from Olympic Organisers to wear black armband to honor Ukrainian sports pipo wey Russia kill for war. IOC tuk, tuk, Mark Adams normally dis move dey against Olympic rules, tuking about political symbols, so dem bin ban am b4. Meanwhile, Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky support Heraskevych right to show respect to fallen […]

todayFebruary 10, 2026 4

Sports

Chukwuebuka Enekwechi Finish Fifth For Madrid Shot Put

By: Esther Ayoola Olympic finalist Chukwuebuka Enekwechi, for men’s shot put, don muscles finish fifth for Madrid World Indoor Tour afta him throw 20.38 metres for men shot put. Di Naija record holder try wella as him compete with plenty world-class athletes wey dey throw pass 21 metres early for season. American Jordan Geist carry di first place, as e match him world lead with 22.04m. Jamaica man Rajindra Campbell […]

todayFebruary 10, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app