Sports

443 Results / Page 5 of 50

Background

Sports

Super Eagles Star Lookman Make CAF Best XI

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles forward Ademola Lookman sef make di best players list for group stage of 2025 AFCON, and na di only Nigerian wey dey di team. CAF pick lookman as one of three midfielders alongside Morocco own Brahim Diaz and Cameroon own Carlos Baleba. Lookman score two goals and give two assists for only two matches, including di match-winning goal against Tanzania. Meanwhile, Nigeria coach Eric Chelle […]

todayJanuary 2, 2026 21

Sports

Lawal Wire SMS To Coach Eric Chelle To Tidy Eagles Defence

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder Garba Lawal don advise Super Eagles Coachie, Eric Chelle and im technical crew say make dem sort di defensive issue of di super eafles for round of 16 Nigeria go face Mozambique Mambas on Monday for Fez Stadium to fight for quarter-final spot. Di former midfielder yarn am for on siddon talk show as fans dey ready cheer Nigeria for AFCON. Lawal talk say […]

todayJanuary 2, 2026 8

Sports

Venus Williams Come Back Australian Open At Age 45

By: Rilwan Agbomeji Seven-time Grand Slam champion Venus Williams don get wildcard to play Australian Open at age 45, and tournament organizers talk say she go be di oldest woman wey ever play di competition. She still tuk say Australia give her many good memories and she thankful for di chance to come back to a place wey mean plenty to her tennis career. Officials confirm say Williams go break […]

todayJanuary 2, 2026 8 3

Sports

Tobi Amusan, Naija Athletes Shine for 2025 World Athletics Rankings

By Ebi Oboko Beta start for Tobi Amusan as she begin di new year as one of di top-three for World Athletics ranking for 2025 season. She join two oda Naija athletes – Ezekiel Nathaniel and Chukwuebuka Enekwechi – wey sti dey top 100 for world. Tobi wey be hurdling queen collect silver medal for 100m hurdles for Tokyo 2025 World Athletics Championships. She gather 1,430 ranking points, just dey […]

todayJanuary 2, 2026 6 9

Sports

Adebayor: AFCON Don Grow with Stronger fighting Spirit

By Ebi Oboko Former Togo striker Emmanuel Adebayor tuk say Africa Cup of Nations don change now, say now, e don dey more comeptitive. Adebayor wey play for AFCON back in the day talk say the tournament no be just football match again. E yan dis one give CAF online, in those day, e dey more raw and simple, but passion still dey strong. Now e don change well well, […]

todayJanuary 2, 2026 5 12

Sports

EPL Result For New Year Day, Draw Full Ground

By Ebi Oboko Thursday for English Premier League, plenty teams no fit score as draw plenty. Brentford vs Spurs, Liverpool vs Leeds  match end 0-0, while Sunderland hold Man City 0-0. Crystal Palace and Fulham share point after 1-1 draw, same time Chelsea draw 2-2 with Bournemouth. Arsenal beat Aston Villa 4-1, and Newcastle waka pass Burnley 3-1. West Ham and Brighton end 2-2, Manchester United and Wolves draw 1-1, […]

todayJanuary 2, 2026 10 9

Sports

AFCON Wahala: Gabon Ban Aubameyang, Manga, Suspend National Team

By Ebi Oboko Gabon sports minister don ban veteran players Pierre-Emerick Aubameyang and Bruno Ecuele Manga, suspend the whole national team, and sack the coaching staff after dem shameful AFCON performance. Dem lose 3-2 to Ivory Coast because Bazoumana Toure score injury-time winner. Gabon con finish last for Group F after dem lose all three matches, even pass Mozambique. Minister Simplice-Desire Mamboula talk say government no go allow Panthers play […]

todayJanuary 1, 2026 17

Sports

Chelsea Fc sharpaly turn Maresca to EX

By Ebi Oboko Chelsea Football Club don announce say dem and dia  head coach Enzo Maresca don agree to part ways on Thursday. During him time, Maresca lead Chelsea win UEFA Conference League and FIFA Club World Cup. Club tuk say di decision follow dia ongoing plans and ambitions for the team. Chelsea thank Maresca for im contribution and say im achievements go remain important part of the club history.

todayJanuary 1, 2026 8 4

Sports

Super Eagles Go Jam Mozambique on Monday for Round of 16

By Ebi Oboko Unto updates for AFCON, Nigeria super eagles go face Mozambique for round of 16 of the 2025 Africa Cup of Nations after group stage end on Wednesday. Super Eagles get their knockout opponent after final matches for Groups E and F round up the first stage of the tournament. Algeria top Group E with full points after dem beat Equatorial Guinea 3–1, while Burkina Faso finish second […]

todayJanuary 1, 2026 11 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app