Sports

443 Results / Page 6 of 50

Background

Sports

Ryan Alebiosu Collect Wunjuri Afta Super Eagles Debut

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles player, Ryan Alebiosu, go dey sideline for one month afta e suffer serious injury for im debut game against Uganda for AFCON 2025 Group C. Alebiosu start di game as Super Eagles win 3-1. Di Blackburn Rovers star wunjuri  happen when Uganda player push am enter advertising board for first half. Even though im dey down small time, Alebiosu still finish di full 90 minutes, […]

todayDecember 31, 2025 6

Sports

Barau FC Comot Ladan Bosso From Work

By: Rilwan Agbomeji Nigeria Premier Football League (NPFL) team, Barau FC, don part ways with dia Technical Adviser, Ladan Bosso. Di club tell tori pipo say Bosso gree step aside afta dem review di team performance for di first stanza of di 2025/26 season. Assistant coach go take over for now as dem prepare for second stanza. Barau FC thank Bosso for im work and wish am better luck for […]

todayDecember 31, 2025 7

Sports

Michelle Alozie Hail FIFPro World XI Nomination As Big Honour

By: Esther Ayoola Super Falcons defender, Michelle Alozie, don troway salutation to her Nigerian teammates say her nomination for FIFPro World XI na big recognition of her hard work with Nigeria national team. According to sport aproko pipo, dem include Alozie among di 26 players wey make di 2025 FIFPro World XI nomination list for October. FIFPro World XI na di only global football award wey professional footballers themselves dey […]

todayDecember 31, 2025 4 2

Sports

Arsenal Show Bad Character Beat Villa 4-1

By: Esther Ayoola Arsenal show serious power as dem beat Aston Villa 4–1 for Emirates Stadium on Tuesday night, take open five-point lead for EPL table. Afta first half tight, Gabriel Magalhaes, Martin Zubimendi, Leandro Trossard and Gabriel Jesus score all di goals for second half. Villa goalkeeper Emiliano Martinez make big mistake for corner, wey give Arsenal di first goal and turn di match around. Di win end Aston […]

todayDecember 31, 2025 6

Sports

Lazio Coach Sarri Do Small Heart Operation

By: Esther Ayoola Lazio coach Maurizio Sarri don undergo small heart operation afta doctors find say im get atrial fibrillation wey dey affect heart rhythm. Di Serie A club talk say di operation be routine and dem expect di 66-year-old manager to resume work in few days. For statement wey dem post for X, Lazio confirm say Sarri do transcatheter ablation for Policlinico Tor Vergata hospital.

todayDecember 31, 2025 1

Sports

Super Eagles Sweep AFCON Group Stage

By: Esther Ayoola Super Eagles of Nigeria don finish AFCON Group C with 100% win record, beating Uganda 3-1 to finish top of di group. Before dis game, Nigeria already beat Tanzania 2-1 and beat Tunisia 3-2, so dem collect 9 points finish di group stage. For di final group match, Super Eagles open scoring 28th minute through Paul Onuachu, and Raphael Onyedika add two quick goals for second half […]

todayDecember 31, 2025 7

Sports

Aruna Quadri Finish 2025 As Africa No. 1 Table Tennis Player, 28th For World

By: Esther Ayoola Nigeria table tennis star, Aruna Quadri, don finish 2025 as Africa number one, International Table Tennis Federation ranking show on Tuesday. Quadri wey don hold Africa top for most part of the year, end the season 28th for world with 1,065 points, the only African wey pass 1,000 points for men ranking. Egypt player Omar Assar follow, e dey 32nd for world with 965 points according to […]

todayDecember 31, 2025 2

Sports

Liverpool Part Ways With Coach Aaron Briggs

By: Rilwan Agbomeji Liverpool Football Club don  share surprise update, dat Aaron Briggs, wey join di club as individual development coach for July 2024, go leave im role with immediate effect. Di club post for dia official website on Tuesday dat, Briggs dey important part of Arne Slot backroom staff and e help Liverpool win last season Premier League. Dem nor  really give full gist on why im dey comot, […]

todayDecember 30, 2025 10

Sports

FRSC Investigate Joshua Road Crash

By: Esther Ayoola Untop di updates of di accident wey involve Nigerian boxing star Anthony Joshua, say di federal road safety don dey touchlight di mata unto wetin really cause di accident Di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn on Tuesday say dem dey wait full technical report to know di exact reason for di crash. Untop yanings for TV sitdon tuk, FRSC spokesperson Olusegun Ogungbemide tuk say preliminary assessment […]

todayDecember 30, 2025 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app