Sports

529 Results / Page 6 of 59

Background

Sports

Chukwueze Enter Nomination For Fulham Goal Of Di Month Award

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger Samuel Chukwueze don get nomination for Fulham Goal of di Month award for January. Dem nominate am because of di goal wey e score for Fulham 2–1 win against Brighton, as e equalize for 72nd minute afta fine control of Joachim Andersen pass. So far, Chukwueze don record five goals and two assists from 11 league matches for di Cottagers. Di 26-year-old wey join […]

todayFebruary 5, 2026 9 1

Sports

Lookman Ask Make Dem Transfer Am Go Athletico Madrid — Palladino

By: Rilwan Agbomeji Atalanta coach Raffaele Palladino don reveal say na Ademola Lookman ask make e comot di club go Atletico Madrid. Lookman complete permanent transfer to Diego Simeone side on di last day of winter transfer window. Atalanta collect €40 million as transfer fee for di Super eagles striker. Palladino talk say Lookman receive di offer towards di end of transfer session, say e want new environment, so di […]

todayFebruary 5, 2026 13 1

Sports

Yamal Shine As Barca Beat Albacete 2-1 Reach Copa del Rey Semi-Final

By: Esther Ayoola Barcelona don reach Copa del Rey semi-final afta dem win 2-1 against Albacete on Tuesday. Lamine Yamal score first just before half-time, and Ronald Araujo add second early afta break. Araujo dey play him first game since im month-long mental health break. Albacete try fight back and Javi Moreno score near di end, but Barca still carry di win.

todayFebruary 4, 2026 9 1

Sports

Kai Havertz Last-Minute Goal Send Arsenal Go Carabao Cup Final

By: Esther Ayoola Arsenal don konfamat demself for Carabao Cup final afta dem beat Chelsea 1‑0 for Emirates Stadium on Tuesday night.   Di match no too get chance, but for last minute of six minutes added time, late goal from Kai Havertz ni wunjure Chelsea for ground.   Dis goal give Arsenal di 1‑0 win for di match and 4‑2 for aggregate, make Chelsea cry beta style.

todayFebruary 4, 2026 9 1

Sports

FIFA Presido Begin Waka To Stop Russia Football Ban

By: Esther Ayoola FIFA president Gianni Infantino don drop yarns say, time don reach to remove Russia from football ban. You sabi say, FIFA banned Russia since dem enter war with Ukraine for 2022. Infantino say, di ban nor hellep anybodi, say, instead e only bring more disappointment and hatred. Di FIFA president dey yarn dis one for TV sit don tuk say, make dem begin allow Russia players to […]

todayFebruary 3, 2026 5

Sports

Team Nigeria, Uzbekistan Land Lagos For Davis Cup Showdown

By: Esther Ayoola Say like dis area dey hot for di Davis cup, dat, Team Nigeria don move dia training camp from National Stadium, Surulere go Lagos Lawn Tennis Club, wey go host dia Davis Cup World Group II match against Uzbekistan on February 7–8. Uzbekistan team sef don land Lagos on Sunday, dem do dia first on-court practice on Monday. Di Uzbek team carry three players plus four officials, […]

todayFebruary 3, 2026 5

Sports

Ronaldo Put Bodi For Conner To Protest Lack Of Signing Of AL-Nassr

By: Esther Ayoola Reports say Cristiano Ronaldo no go feature for today league match, even though e dey fully fit. Planet Football report on Monday say di Portuguese star, wey dey play for Al-Nassr for Saudi Arabia, take dis decision for February 2026. Ronaldo, five-time Ballon d’Or winner and one of football greatest players, don get history of showing frustration when things for him club no dey go di way […]

todayFebruary 2, 2026 6

Sports

3SC Chairmo Promise Fans To Repair Lekan Salami Stadium

By: Esther Ayoola Shooting Stars Sports Club (3SC) chairmo, Hon. Taiwo Lekan Salami, don assure fans say dem no go move di team comot from Lekan Salami Stadium for NPFL matches. Dis one dey come afta NPFL tuk say, di  stadium pitch no dey fit to host league match, particularly di one for TV broadcast. Hon. Salami say, dem don raise bodi for di mata on how to repair di […]

todayFebruary 2, 2026 4

Sports

Victor Osimhen Hit 200 Career Goals

By: Esther Ayoola Na historic weekend for Naija football, as Victor Osimhen score im 200th career goal on Sunday helping im club to collobi betterlicious 4 kondo victory over Kayserispor. Di Galatasaray striker score di second goal as dem beat Kayserispor for Turkish Super Lig. So far, Osimhen don play 336 games, score 200 goals, and give 51 assists for club and country. And majority of di goals come for […]

todayFebruary 2, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app