Sports

444 Results / Page 9 of 50

Background

Sports

AFCON – Naija Super Eagles Show Workings Beat Tanzania 2-1

By: Rilwan Agbomeji Nigeria don start dia AFCON 2025 campaign well, as Super Eagles beat Tanzania 2-1 for Stade de Fez, as Semi Ajayi and Ademola Lookman score. Tanzania try fight back, even score one, but Lookman quick reply make Nigeria take all three points. With dis win, Nigeria dey top Group C join with Tunisia wey beat Uganda 3-1 while Tanzania go need beta result next match.    

todayDecember 24, 2025 9

Sports

Troost-Ekong Collect National Honour Certificate From Presido Tinubu

By: Rilwan Agbomeji  Retired Super Eagles captain William Troost-Ekong don receive national honour certificate from Presido, Bola Ahmad Tinubu on Monday. Troost-Ekong announce di receipt for X on Tuesday, say e dey proud for im and im family. Di award na Member of di Order of di Federal Republic (MFR), wey Tinubu giv am for official ceremony. E thank President Tinubu for di honour, call am big recognition for im […]

todayDecember 23, 2025 10

Sports

EPL: Liverpool’s Isak Do Surgery For Leg, Say Im Go Dey Out Months

By: Esther Ayoola Liverpool don share update dat dem don do surgery for Swedish striker Alexander Isak afta im wunjor im leg for Saturday match against Tottenham. According to report on Tuesday, say di Sweden striker leg dey broken, fibula scatter small, but surgery go well. Club never yarn how long e go take recover, but dem talk say Isak go dey sideline for at least  few months.

todayDecember 23, 2025 7

Sports

Tanzania Eyes First Ever Afcon Win Say Na Nigeria Dem Wan Take Start

By: Esther Ayoola Tanzania cochie, Miguel Gamondi,  ni bring mata dis morning on say if  dem fit finally get dia first victory when dem play Nigeria for 2025 AFCON for Morocco on Tuesday, e go belike say na world cup dem win. Di taifa stars don play three AFCON tournaments—1980, 2019, and 2023—and dem never win any of dia nine matches, so dis group C opener go be dia 10th […]

todayDecember 23, 2025 4

Sports

Zambia Carry Last-Minute Draw Against Mali For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji AFCON 2025 Group B take enter stage on Monday Afternoon as Zambia and Mali take play 1-1 draw. Mali start sharp from kickoff and create plenty chances, but El Bilal Touré miss big penalty for 41st minute. For 60th minute, Mali finally score when Lassine Sinayoko finish clean from corner move. Zambia no gree loss, Patson Daka later score one mad equalizer wey carry di game enter […]

todayDecember 22, 2025 14

Sports

Tanzania Go Make Match Hard For Super Eagles – Onazi

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder, Ogenyi Onazi don warn say Tanzania go make life hard for Super Eagles for dia AFCON 2025 Group C match on Tuesday for Morocco. Onazi yarn for TV siddon talk say players gatz prepare well if dem wan collect full three points. Super Eagles dey favourite to top di group wey get Tunisia and Uganda join body.  

todayDecember 22, 2025 9

Sports

We Ready Well-Well To Face Nigeria – Gomandi

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coachie Manuel Gomandi talk say im team don ready for AFCON 2025 Group C opener against Nigeria. Dem go face Super Eagles for AFCON first time since 1980. Dem lose 3-1 back then, wey Christian Chukwu lead Nigeria to di African Championship.

todayDecember 22, 2025 6

Sports

Lookman Yarn Say AFCON 2025 Cup Na For Naija

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Ademola Lookman don clear marras dat di Super Eagles ready to go di extra mile to collobi di 2025 African Cup of Nations Dis yarnings dey follow fans demand on social media mata say Naija miss out for di 2026 world via penalty to Dr Congo Lookman respond for TV siddon talk dat di team go correct di past by showing correct skills and […]

todayDecember 22, 2025 7

Sports

Super Eagles Train For Morocco Ahead AFCON Match With Tanzania

By: Esther Ayoola Super Eagles don hold dia fourth training session for FES, Morocco, on Sunday as dem dey prepare for dia 2025 AFCON Group C match against Tanzania on Tuesday. Nigeria go face Tanzania for di Complex Sportif de Fes for dia first Group C game. Di team wey land Morocco last Thursday don also train on Friday and Saturday to sharpen dia preparations. Before dem reach Morocco, di […]

todayDecember 22, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app