OBODO NAIJA

FG Send South Africa Message To Stop Attacking On Nigerians Now

todayJuly 28, 2026 3

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Wi Federal Government don warn South Africa make dem take serious action to stop di fresh wave of xenophobic attacks wey dey target Nigerians and oda Africans for dia country.

Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, yarn dis one during meeting with South Africa Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, say na about 98 Nigerians don kpai  since 2022, and criminals suppose face arrest and court, no be mob justice.

Say dis meeting na baba Presido, Bola Tinubu order am, and dat e get di way south Africa go behave e go affect naija relationship with South Africa

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds