By: Jolayemi Olajide
IMF don warn say AI market crash and cyber attacks fit cause serious wahala for world financial system.
Di International Monetary Fund drop dis warning on Tuesday for dia latest Global Financial Stability Report, wey dem release during annual meeting with World Bank for Bangkok, Thailand.
IMF talk say rush to develop AI, produce computer chips and build data centres don dey push world economy forward, but di AI boom still carry risks wey fit shake di global economy.
IMF deputy director for Monetary and Capital Markets Department, Athanasios Vamvakidis, say some cyber attack risks don already show face, but plenty oda dangers still dey wey dem never fully understand.