By: Mariam Ajayi
Wi First Lady, Mama Oluremi Tinubu, Aka Iya alakara, like dis dey beg Nigerians say make dem support her hubbi, Presido Bola Tinubu for second term.
She drop dis micro soft word on Sunday for Lafia, Nasarawa State, during rally wey North-Central Grassroots Mobilisation Network organise to gather support for Tinubu and Vice Presido Kashim Shettima.
Senior mehn like, APC National Chairman, Nentawe Yilwatda, Imo State Govo, Hope Uzodimma and oda party members from North-Central attend di rally.
Remi say Tinubu message for Independence Day, wey dem title From Reforms to Prosperity, show say di gornment wan move from hard economic policies to better life for Nigerians.