By: Yusuf Abuh
Oga Presido Bola Tinubu don approve ogbonge salary increase of between 30 and 80 per cent for about 250,000 Army men, and di new pay package go begin from September 1, 2026.
Di Presidency announce di increase for statement on Tuesday, saying junior soldiers from private to staff sergeant go get 80% raise, warrant officers to colonels go collect 50%, while brigadier-generals to generals go earn 30% more.
According to di Presidency, di salary review hapun because of di sacrifices wey military personnel dey make to fight terrorism, banditry and kidnapping across di country.