Wi oga Presido, Bola Tinubu don rake again, say if bad belle pipo like, make dem tuk from now till tomorrow, dat wetin im knw be say Naija economy don bunch back like bounchy bounchy cattle.
Na oga Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, mouth naim yarn dis one on Tuesday after e lead di National Communications Team go meet di Presido for wi decision headquaters.
According to Idris, as dem enter area, na so baba Seyi begin rake, say gornment policies e choke, security e choke.
Say di only tin wey remain na for Nigerians to jump untop di opportunate wey dis gorment don bring come.