BOLA AHMED TINUBU

35 Results / Page 3 of 4

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Cancel Ogun Trip, Waka Go Jos On Top Insecurity Marras

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don cancel im Ogun trip wey suppose happen on Wednesday, make im first waka go Jos, Plateau State, to feel with victims of di gbege wey kpai at least 27 pipo for Angwan Rukuba district on Sunday. Na Special Adviser to di Presido on Informate and Strategy, Bayo Onanuga, talk am for statement wey im sign on Wednesday. Di move come after Tinubu and Plateau State […]

todayApril 2, 2026 14

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Meet Ganduje, Badaru As Kano, Jigawa Politics Dey Shake Up Ahead 2027

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu don meet former Kano govo, Abdullahi Ganduje and ex-Defence Minister Badaru Abubakar for Aso Rock as politics dey shakeup for Kano and Jigawa. Though wetin dem discuss never come outside, pipo believe say na plan to make All Progressives Congress strong again for di states. For Kano, mata  hot, as Rabiu Musa Kwankwaso and im supporters dump New Nigeria Peoples Party go join All […]

todayApril 1, 2026 13

National

President Tinubu Appoint Sen. Ibrahim Ida As CAC Chairman

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don appoint Sen. Ibrahim Ida as Chairmo of di Corporate Affairs Commission (CAC). Presidential tuk, tuk, Bayo Onanuga, ni put for statement on Monday. Say, baba Seyi, sti nominate seven pipo as Federal Commissioners to fill vacancies for di National Population Commission (NPC), but National Assembly go sti need  konfam dem. Sen. Ida, before e become Senator for Katsina Central for 2017, […]

todayMarch 31, 2026 19

National

President Tinubu Share Hope Say Naija Go Overcome Hardship

By: Esther Ayoola Oga Presido Bola Tinubu, drop ogbonge hope, say Naija go fit overcome di jogolo wey kontri man and woman dey face. Im yarn dis one afta im special birthday prayers wey dem do for am for National Mosque for Abuja. Tinubu tuk say e dey grateful to God and reflect dat, di country economic situation wey Naija dey face, say na just small time, everybody go dey […]

todayMarch 30, 2026 11

National

President Tinubu Honour Fallen Hero, Promise To Give Im Entire Salary

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don announce say im wan create special fund to support soldiers, including those wey get wunjury and for families of those wey kpai for service. Im tuk dis one for statement  on Sunday as E dey mark im 74th birthday, say na to appreciate di sacrifice of Armed Forces. Baba Seyi say Im don direct Accountant-General make dem open special account for […]

todayMarch 30, 2026 23

Lagos

Egbetokun Give Tinubu Big Salute for Life Guidance

Di immediate past Inspector-General of Police, Olukayode Egbetokun, cut cap wetin nor good for wi oga Presido, Bola Tinubu, say na Tinubu leadership make am succeed. E tuk dis talk during im retirement thanksgiving service for Victoria Island, Lagos. E explain dat im first meeting with Tinubu for 1998 change im life. E still thank God for im career and say faith plus resilience na wetin carry am through di […]

todayMarch 29, 2026 33

Lagos

Governors Forum Tell Oga Presido Dia Plans On State Police

By: Esther Ayoola Naija Governors Forum like dis now say, dem don give dia own idea for di proposed state police to National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, wey go carry am go National Assembly. NGF Chairmo wey be Kwara State Governor, Abdulrahman AbdulRazaq, tuk dis one when e meet President Bola Tinubu for im house for Ikoyi, Lagos. AbdulRazaq say tuks on state police sti dey go on with […]

todayMarch 23, 2026 14

Lagos

President Tinubu Link Up With Macron, France To Fight Terrorists

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu like dis now dey say Naija get agreement with France Presido, Emmanuel Macron, to support our military with ogbonge equipment and training. Oga Presido yarn dis one when he dey tuk with governors for him Ikoyi house for Lagos afta him come back from UK trip. Baba Seyi say Naija ready to use di good relationship and gbese wey we get to […]

todayMarch 23, 2026 16

National

President Tinubu Order All Appointees Wey Wan Contest 2027 Election To Exit Im Gorment

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don order, say make all im political appointees wey wan run for any election for 2027 resign from dia work before March 31. Head of Information for OSGF, Dewan Goshit, naim announce dis news on Tuesday. Baba Seyi say, dis follow Section 88(1) of di Electoral Act 2026 and di INEC timetable for party primaries. Dis order dey affect all presidential […]

todayMarch 18, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds