IRAN

77 Results / Page 5 of 9

Background

obodo oyinbo

America, Iran To Restart Peace Tuk Despite Ceasefire End

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido,  Donald Trump don drop micro soft word  say America go continue peace tuks with Iran, even as after dem announce say cease fir don end. Trump tok dis one for im Truth Social page, wia e make am clear say di truce no dey again. E also blast Iranian leaders, call dem "bad pipo," and say na dem go decide whether dem go return […]

todayJuly 10, 2026 19

obodo oyinbo

US Forces Launch Heavy Strike Inside Iran

By: Yusuf Abuh US military don launch heavy air strikes inside Iran on Tuesday after Iran forces attack three merchant ships for inside di Strait of Hormuz. US Central Command tuk for X (Twitter) konfam say hand really touch Iran oh, nor be small. Di US military dey vex say wetin Iran do pass line, e dey dangerous, and e break di ceasefire agreement wey start since April 8. Dis […]

todayJuly 8, 2026 18

obodo oyinbo

Iran Warn Trump Say Dem No Go Reach Agreement If Threat Continue

By : Jolayemi Olajide Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don warn Donald Trump say if dem continue dia threat, dem go stop peace talks. Im tuk dis one give tori pipo on Monday, after report say, Trump America  dey plan force di peace  agreement with Iran. Iran dey insist say, nor be everything dem go use force, but if US insit dem go give dem hot, hot.

todayJuly 7, 2026 16

obodo oyinbo

Iran Rake Say US And Israel Na By-Force Dem Take Recognize Iran Regional Power

By: Yusuf Abuh Iran parliament tuk, tuk, Mohammad Ghalibaf, don drop a bumbshell say United States and Israel nor get level naim make dem sign agreement to work together. Ghalibaf yan dis word for meeting with Yemen Vice Presido, Mohammed Al-Nuaimi, as e dey praising dis e achievement, say no level. E follow talk say di agreement na big political and military failure for America, but na massive win for […]

todayJuly 6, 2026 25

obodo oyinbo

Iran Warn US & Israel As 20 Million Pipo Gather For Khamenei Burial

Iran top negotiator don sama warning say, if US and Israel refuse to end di war as dem promise, Iran go change am for dem. Dis warning dey come as over 20 million pipo gada  for Tehran for di burial of former Supreme Leader Ali Khamenei, wey kpai follow im family members since di war start. Iran army commander self done swear say dem must revenge di blood of Ayatollah […]

todayJuly 3, 2026 22

obodo oyinbo

Iran Warn US Make Dem Clean Dia Mouth

Iran don warn United States say make dem “dey careful oh” after Presido, Donald Trump go threaten say im go attack against Iran sake of di war for Hezbollah. Dis warning come as both countries still dey hold peace tuks for Switzerland to try end Middle East war and reduce tension. Iran tuk, tuk, Mohammad Bagher Ghalibaf, say dia military ready oh, any kpoko, dem go do kpaka, and say, […]

todayJune 22, 2026 22

obodo oyinbo

Iran Leader Accept Peace Deal Wit US

Iran supreme leader, Ayatollah Mojtaba Khamenei, don finally konfamate  say im hand dey for peace deal wey US Presido Donald Trump sign to end Middle East war, even though say nor be every tin inside di deal dey give am joy. And dat joy is coming in di morning. Di agreement go also allow US lift blockade for Iran ports and open road for 60 days tuk, on matas like […]

todayJune 19, 2026 27

obodo oyinbo

Iran Say Dia Missile Programme No Dey On Top Table

Gbege don finally drink water keep cup for inside di middle east as US Presido, Donald Trump and Iran Presido Masoud Pezeshkian sign one peace deal wey dem dey call Memorandum of Understanding, for early mormor on Thursday. Dis deal go open door for fresh talks on top Iran nuclear programme and possible removal of sanctions wey dey affect Tehran. But one major issue wey di deal no touch be […]

todayJune 18, 2026 14

Sport Yarns

Iran players to Miss World Cup Match cause of Expired Visa to America

By : Jolayemi Olajide Iran national football team don dey complain say one of dia star players, Mehdi Torabi, visa don expire after dia match for Los Angeles. According to di aproko, Torabi only get single-entry visa, unlike im oda teammates wey get multiple-entry, so now e nor fit enter di US again to continue di tournament. Iran Football Federation don already start work to see how dem go quickly […]

todayJune 16, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds