IRAN

45 Results / Page 5 of 5

Background

obodo oyinbo

US Send 15-Point Peace Plan To Iran

Iran don receive 15-point peace plan from US, and dat na Pakistan deliver am as intermediary dis week to try settle di nuclear issue. Di plan, wey dem no show to  public, fit help stop some of Iran nuclear facility and US suppose also remove sanctions from Iran. One Israeli minister explain di mat give tori pipo on Tuesday say di plan fine for paper, but e be like say […]

todayMarch 25, 2026 18

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Again Says U.S Dey Tuk With Iran To End Di War 

US Presido Donald Trump  again say dem still dey try negotiate with Iran, even as Iran yarn say di tuks na fake news. According to report U.S and Israel sti attack Iran yesterday, and for one strike for south Tehran, at least 12 pipo kpai and 28 wunjor. Iran and Hezbollah sti  fire new set of missiles reach Israel, including Tel Aviv and di north, kpaing one person and wunjor […]

todayMarch 25, 2026 19

obodo oyinbo

US Military Say Iran Threat To Strait Of Hormuz Don Reduce Well Well

US military don yan say Iran fit no fit threaten Strait of Hormuz again after dem bomb underground place wey dem dey hide cruise missiles and other weapons dis week. Iran don dey block di Strait, wey dey carry one-fifth of world oil, so US come use heavy heavy bombs strike di missile sites wey dey around. CENTCOM oga, Admiral Brad Cooper, talk say dem drop plenty 5,000-pound bombs for […]

todayMarch 21, 2026 21

obodo oyinbo

Qatar Say Make Iran and US Settle Marras

Qatar foreign minister Mohammed bin Abdulaziz al-Khulaifi tok for Doha say make Middle East calm down and say Iran and US suppose reason and settle demselves soon. Di minister say Iran attacking dia neighbours nor get any good, say e dey pain dem but dem gat reply U.S. Iran fire missile and drone after US and Israel bombard dem for almost two weeks, wey cause kasala and damage important place […]

todayMarch 11, 2026 23

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Beg Authorities Make Peace Return To Iran

By: Esther Ayoola Pope Leo di fourteen XIV say, worry dey wound am wetin nor good,  as di  war for Iran dey  spread enter oda countries for di Middle East. E tuk say di fight wey don reach nine days since US and Israel attack Iran dey bring hate to di region. Oga Pope dey beg authorities, make dem stop di fight quick and start tuk for peace.

todayMarch 9, 2026 12

obodo oyinbo

Late Iran Supreme Leader Pikin Take Over Gorment

By: Esther Ayoola Son of late Supreme Leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, don become new Supreme Leader for Iran. Iran Assembly of Experts, 88 clerics wey dey choose Supreme Leader, ni pick am afta Ali Khamenei kpai for U.S.–Israeli strike. Mojtaba na hardline cleric wey get strong connection with Iran Revolutionary Guard Corps, and now, na aim go dey control of political matas, army, and strategic programs.

todayMarch 9, 2026 16

obodo oyinbo

US And Iran To Put Bodi For Meeting To Settle Dia Quarrel Today

By: Esther Ayoola US and Iranian top official say, dem go meet for Oman today to calm tension between di two. Say Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don waka go Muscat for di talks. For U.S. side, Trump pipo like Steve Witkoff and Jared Kushner go join di meeting, say if nothing come out from dis meeting, war go fit start between di two countries.

todayFebruary 6, 2026 42

obodo oyinbo

Iran Presido Pezeshkian Konfam Dia Tuk Wit USA

By: Esther Ayoola Iran Presido, Masoud Pezeshkian on Tuesday say im don ready to start tuks wit United States, if only di tuk nor go bring problem to Iran. US Presido, Donald Trump, bin warn Iran say “bad things go hapun” if Iran nor strike Nuclear deal with dem. Arab official wey no give im name, say dem fit meet for Turkiye on Friday for di tuks, as Egypt, Qatar, […]

todayFebruary 4, 2026 19

International

Iran and European Powers Go Hold Talk About Nuclear Matter as Tension Dey Rise

Iran Foreign Minister Abbas Araghchi go talk on phone with him French, British, and German counterparts this Friday to discuss how their nuclear talks don jam ground and the risk of fresh sanctions. The three European countries warn say if Iran no come back to table, dem fit activate United Nations “snapback” sanctions wey go bring back old punishments wey dem lift before. USA also believe say Iran nuclear moves […]

todayAugust 22, 2025 35 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds