LAGOS STATE GOVERNMENT

19 Results / Page 1 of 3

Background

Lagos

Lagos Gorment Approve 13% BRT Fare Increase From March 2

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don approve BRT bus fare increase by 13% say na Bus Reform Initiative schemes. LAMATA Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi ni put dis for statement give tori pipo, say Govo Babajide Sanwo-Olu gree for di increase because bus operators dey complain money nor reach dem do anything. Ojelabi say, di new fares go start from Monday, March 2nd, 2026.

todayFebruary 24, 2026 7

Lagos

Education Stakeholders Call Gorment To Arrange Lagos Future

By: Esther Ayoola Education pipo for Lagos on Thursday don clear gorment dia mind, say dem need sharp doings, inclusion, teacher training, correct data and beta action plans to build strong education system. Dem tuk dis one for 2026 Lagos State Education Stakeholders panel wey Ministry of Basic and Secondary Education package. Different partners like UNICEF, British Council, SKLD and New Globe show face for di programme, as dem press […]

todayFebruary 20, 2026 3

Lagos

Lagos Gorment Set To Release Flying Cameras To Boost Security

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say now, dem wan to dey use surveillance drones to boost security work across di state. Executive Secretary of Lagos State Security Trust Fund, Ayodele Ogunsan, ni dey tuk dis one during press conference to mark him first 100 days for office. According to am, dem dey plan sign agreement with Nigerian Air Force and Naija Police Airwing to support beta aerial monitoring and […]

todayFebruary 17, 2026 7

Lagos

Lagos Gorment Ginger Area To Keep Lagos Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Permanent Secretary and Solicitor General, Hameed Oyenuga, dey cry wetin nor good say Lagos dey smell eh, say Lagos dey smell, all because of pipo just dey troway dirty yangayanga everywhere. E yan dis one for ogbonge two-day retreat wey Lagos State Special Offences Mobile Court hold for Amber Residence, Ikeja. Dem title di retreat “Di Mandate of di Lagos State Special Offences Mobile Court, […]

todayFebruary 13, 2026 6

Lagos

Lagos Gorment Close Lagos–Abeokuta Expressway Say Dem Wan Package Di Road

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say, dem go partially close Lagos–Abeokuta Expressway for four weeks. According to di Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, di closure go start from today Wednesday, February 11, make Federal Ministry of Works fit repair some bad portions of di road. Di repair work go cover di stretch from U-Turn Bus Stop reach Sango Tollgate. Both pipo wey dey go Lagos side and those wey […]

todayFebruary 11, 2026 12

Lagos

Lagos Gorment Push Beta Crib For Pipo Weh Get Disability

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say, dem dey serious about inclusive housing development, and say dem dey put do correct doings for pipo wey get disability for all housing projects for state. Na Permanent Secretary for Lagos State Ministry of Housing, Abdul-Afeez Toriola, tuk dis one when officials from Lagos State Office for Disability Affairs visit dia office. Toriola say, ministry don dey include special provisions for pipo wey […]

todayFebruary 6, 2026 7

Lagos

Lagos Govt Carry Mobile Court Enter Road, Teach Pipo Traffic

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don carry Special Offences (Mobile) Court waka go different parts of di state to sensitize people on traffic and environmental laws. Di programme wey hapun Friday for Lagos Safety Arena and areas like Oshodi, Iyana Ipaja, Ojota and Ikorodu na to teach people make dem obey law. Dem focus on one-way driving, misuse of BRT lane and blocking public spaces. State Attorney-General, Lawal Pedro […]

todayFebruary 3, 2026 9

Lagos

Lagos Muslims Push For More Inclusion For Gorment

By: Esther Ayoola Muslim Community of Lagos State, MCLS, don raise concern say, di way gorment take dey sideline Muslims for political appointments and governance for di state, say e nor dey sweet dem for belle. Di group tuk dis one for last Saturday during dia first General Assembly wey dem hold for Lagos State Secretariat Mosque Hall, Alausa, Ikeja. MCLS lament say Muslims dey excluded especially for education sector, […]

todayFebruary 2, 2026 5

Lagos

Lagos Gorment Teach Civil Servants About Pension

By: Esther Ayoola Di Lagos State Head of Service, Bode Agoro, don ask public servants make dem start to learn about pension, say e dey improtakpa to avoid confusion later once dem retire. Agoro tuk dis tuk on Tuesday during Pension Awareness Programme wey Lagos State Pension Commission organize for Public Service Office, Alausa, Ikeja. E  say di programme na serious move to make sure workers  for di state wey […]

todayJanuary 21, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app