Nigeria Politics

53 Results / Page 3 of 6

Background

Lagos

 Lagos PDP Deny Tinubu 2027 Endorsement

By : Jolayemi Olajide Lagos State chapter of Peoples Democratic Party, PDP, don deny report wey claim say di party don endorse Presido Bola Tinubu and im administration ahead of di 2027 general election. Di party tok dis one for statement wey im Publicity Secretary, Christopher Odianarewo, release on Tuesday, saying di report na false and Nigerians make dem ignore am. According to PDP, Presido Tinubu no be member of […]

todayJuly 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Obasanjo Warn Say Make Nigeria No Allow Civil War Again

Former President Olusegun Obasanjo don warn say plenty of di things wey cause Nigeria Civil War for 1967 still dey ground, and everybody must join hand make dat kind wahala no happen again. Obasanjo tok dis one on Wednesday as e receive book, research materials, videos and interviews about di Asaba Massacre from Chief Chuck Nduka-Eze for di Olusegun Obasanjo Presidential Library, Abeokuta. E praise Nduka-Eze for keeping di history […]

todayJuly 2, 2026 20

OBODO NAIJA

Obi Call Tinubu Say Make E Resign Over Hardship

By: Yusuf Abuh   Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don call out wi oga Presido Bola Tinubu, say make e resign, saying di gornment don fail Nigerians as hardship, insecurity and poor living condition use rain coat wear Nigerians. Obi tuk dis one for im X handle on Monday after British Prime Minister Keir Starmer announce say e go step down from office. Di former Anambra govo […]

todayJune 23, 2026 15

OBODO NAIJA

DSS witness Adeyanju implicate El-Rufai say im wiretap NSA phone

By : Jolayemi Olajide Gbege don burst for Federal High Court Abuja as DSS witness go tuk wetin im see,  say former Kaduna Govo, Nasir El-Rufai, confess say e wiretap di phone of National Security Adviser, Nuhu Ribadu. Di witness, Deji Adeyanju, tell di judge on Monday say na  El-Rufai open mouth konfam dis tin during one live interview for TV sit down tuk Adeyanju, wey be de second person […]

todayJune 22, 2026 13

Politics

Kingibe Clear Air On Natasha Suspension Report

By : Jolayemi Olajide Somebody shout power, nor be small tin as  Senator wey dey represent FCT for Senate, Ireti Kingibe, drop micro soft word say she nor see di committee report wey lead to the suspension of Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan. She yarn this one on Wednesday during interview for tv sit down tuk. According to am, she bin dey attend tax reform retreat when di Senate  consider […]

todayJune 18, 2026 20

south west

Governor Adeleke ask Police to Commot Security for APC Local Gofnor Chairmen

  By : Jolayemi Olajide Osun State Governor, Ademola Adeleke, don tell the Inspector General of Police make e order im men to commot security personnel from di local gofnment chairmen wey belong to APC. Baba govo, Adeleke sorosoke dis one for Osogbo, as im ma dey touch light di Federal High Court judgement wey throway im party Accord Party and five others through window. After di judgement, na so […]

todayJune 16, 2026 21

Politics

Court order police to arrest Omoyele Sowore

By  : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order say dem must arrest AAC presidential candidate, Omoyele Sowore, sake of say im nor show face for im trial. Dem suppose start the case wia DSS charge Sowore for cybercrime, dem say e call Presido, Bola Tinubu, "criminal" for social media. Sowore bin don tell court say na im go defend imself since im lawyers don comot body for […]

todayJune 16, 2026 19

Politics

Atiku Abubakar pick Rotimi Amaechi as running mate for 2027 presidential race

By : Jolayemi Olajide Di African Democratic Congress (ADC) don officially announce former Rivers State Governor and ex-Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, as the vice-presidential candidate to join forces with Atiku Abubakar for the 2027 general election. Di party National Publicity Secretary, Mallam Bolaji Abdullahi, reveal dis news on Monday, explaining say dem take di decision after serious consultations wit party leaders, stakeholders, and representatives from all di six geopolitical […]

todayJune 16, 2026 17

Politics

Court Order INEC to Wipe Out ADC, Four Other Parties From Election List

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order make INEC deregister ADC and four other political parties say dem nor reach  meet constitutional requirements. Justice Peter Lifu give di judgment on Monday, say di parties no fit get di required 25 per cent votes for di last general elections. Di affected parties na ADC, Accord, Action Alliance, Action Pipos Party and Zenith Labour Party. Di court also […]

todayJune 15, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds