Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don yarn say fuel price don dey too high for Nigerians, and don start plans to reduce di sufferness wey citizens dey face.
Dis one dey inside statement wey Hamisu Muhammad Gumel, Chief Press Secretary to Jigawa governor, release give media tori pipo.
Di Governor talk dis one during Eid-el-Fitr celebration for Dutse, after e receive Emir of Dutse and other traditional oga dem for Hawan Bariki Durbar on Saturday.
According to am, di situation no sweet oga presido belle and e don start move to make things easy, including plan to reduce transport cost across di country.
E add say recent increase for fuel price, wey connect to happenings for Middle East, don put more pressure on Nigerians, especially for transport and cost of living.
Written by: Ridwan Agbomeji
Fuel price middle east Nigeria President Tinubu
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026