By: Esther Ayoola
US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working.
According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions since e return power.
E don been yabyab di Kennedy center say “na old school,” shapparly do small innovation, put small, small new tins for di place, con put im name for di place based on im workings.